Charles V. Webb Jr.

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Charles V. Webb Jr.
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromAmerika Chenj-am
Fest nemCharles Chenj-am
Famili nemWebb Chenj-am
Wen dem bon am17 April 1910 Chenj-am
Ples wey dem bon amEast Orange Chenj-am
Wen e kpai15 May 2010 Chenj-am
Place of deathEast Orange Chenj-am
Wok wey e dey dulawyer Chenj-am
Party wey e dey for politisRepublican Party Chenj-am

'Bold text'Charles W. Webb Jr. (dem bon am for April 17, 1910 an e kpai for May 15, 2010) na American Republican Party politishian fom one siti wey dem dey kol Essex County, New Jersey for inside United State of America.

Tori of e life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Charles W. Webb Jr. bin finish fom Orange High School for year 1927. E kom wok as pesin wey dey kip moni for di Newark law office of George S. Hobart wey bi bifor bifor Spika of New Jersey General Assembly. Charles leta apliar mek New Jersey Supreme Court gif am Satifiket to fit wok as law clerk. E leta rid law for the firm wey dem dey kol Hobart and Minard (onda koret supervise of George Hobart) till wey e kom pass di exam wey im go tek to bikom lorya for di siti of New Jersey for United State of America for 1934 an e don rait anoda two-days exam for counselors for 1937. For 1952, Gofnor Alfred Driscoll kom chuz Charles W. Webb Jr. mek im go saf as Prosecutor for Essex County. Afta di Stet Senate don komfam am, Charles enta ofis on November 13, 1952 kom saf go rish February 16, 1959.

Charles kontest for New Jersey State Senate in 1959, as e shalenj Donal C. Fox di Demokrat wey bi di pesin wey dey ofis dat taim.Charles kontest on top di Essex Republican Organization platform wit sopot of County Chairman William Yeomans bot e faze one strong opponent in di GOP primary: bifor bifor Stet Senator Alfred C. Clapp, who bin don gree to lid som kandidate wey bin get som reform agenda wey dey difren fom dat of William Yeomans. Na so Clapp kom tek win Webb wit votes wey passs 20,000(31,551 (72%) to 12,177 (28%)) an all his 12 Assembli kandidate kom win di primari. Na dis Webb defit for 1959 pamari kom klair road for Congressman Robert W. Kean to defit William Yeomans insaid di eleshion for Essex County Republican Chairman one week leta.

After im don lose di Senate eleshion, Charles kom stat im own law firm, Webb, McDermott & McGee, wey bi sey na medikal malpractice difense dem dey du. Charles W. Webb Jr. ritaya for 1975. Im marry Rosemary T. Wiesel fom 1936 till shi dai for 1982. Charles W. Webb Jr.dai for 2010, wey no rish one month afta im rish 100 years.

How we tek gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]