Carmen Roy

From Wikipedia
Carmen Roy
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromCanada Chenj-am
Fest nemCarmen Chenj-am
Famili nemRoy Chenj-am
Wen dem bon am1919 Chenj-am
Wen e kpai9 April 2006 Chenj-am
Wok wey e dey dufolklorist, ethnologist Chenj-am
Awod wey e koletQ3332224 Chenj-am

Bold text'Carmen Roy na wuman wey dey stodi difren kolshor an rait abaut tradishonal tori.Na e du di vois stodi for di :'Gaspé Peninsula. Roy don hep kolet an kip meni old old tins an e don bi season daretor for Kanada Nashonal Muslim wey de Ottawa from 1940s go rish di 1980s. Wen e wok wit Marius Barbeau an Luc Lacouciere, Roy join hans mek pipul like kolshor tins in Canada an e na one of di earli pipul wey stat tradishonal tori raita in Canada. As an administrator for di Nashonal Musium, Roy hep organize di Scholarship of koleshon like Helen Creighton an Edith Fowke.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Cap-Chat wey dey Gaspé Peninsula e gro up.For dia, Roy yuz anaoda nem tek dey rait poem. Di nem wey Roy dey yuz na "Mouse Des Boos".Roy leta go "College Marguerite-Bourgeois" in Montreal wie e komplet e baccalauréat en Lettres in 1942.E den go rid French at di Université Laval. Wen e stil dey Quebec siti, Roy stat to like tradishonal tori afta e mit Marius Barbeau in 1947.Wit Marius Barbeau hep, Roy get wok for Nashonal Musium of Kanada.Roy yuz free edukeshon du e Ph.D in "Ethnography" at di Sorbonne in 1953.For that e Ph.D, e wok onda Marcel Griaule an e pepa wey e tek get e Ph.D na "Literature orale en Gaspesis". Dos akademishan wey joj e pepa na Charles Bruneau an Henri-Irénée Marrou.Som pipul tok sey Carmen Roy de among di fest Wuman-dem wey wan kolet Ph.D sertifiket.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sins Roy na oga for French-Canadian an Acadian tradisonal tori, E wok in di koleshon of old old tins for "Canada's National Museum"wey dey Ottawa from 1948 go rish 1956.From 1948 go rish 1952, Roy hep organize vois rekod of Gaspe Peninsula pipul-dem. Di rekod kontain wetin pipul len or si long time ago wey kom hep to stat di foundashon of dia tradishonal tori wey pipul fit yuz for dia akademik wok.