Brita Biörn

From Wikipedia
Brita Biörn
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromSweden Chenj-am
Fest nemBrita Chenj-am
Wen dem bon am1667 Chenj-am
Wen e kpai1745 Chenj-am
Wok wey e dey ducunning folk Chenj-am

'Bold text'Brita Börn, or Brita Biòrns (dem bon am 1967-fl. an e kpai 1745), na swedish wuman, wey dem Sabi for Gotland as wuman wey im way no dey pure, an shi dey insaid Swedish wuman wey dia way no pure wey live dat time. Dem Kari am go two court an court tok sey im way no pure.

Hau e tek live life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Brita Biörn mari boatswain Jons Biörn in 1960 an Pehr Biörn in 1704, but e no kon get hosband in 1718. Shi bon one pikin wey bi boy for im fest marriage. E dey posibu but dem no komfam am sey im sekond hosband na im first hosband broda. Na for Gammelgarn Dem bon am, but na Gothem shi live for 1685.

Plenti Pipul Sabi am wel as wuman wey im way no dey pure, Bikos of her way we no dey pure, Parish Vicar of Gothem, Nicias Lutteman, tok sey na shi bi Ashawo in 1722. For kourt shi tok sey na one man wey bi Jacob i Halla, wey Kari am go meet Di sma undar Jordi , wey dey stay insaid water tich am hau persin wey no go dey pure. Shi tok sey hol im bodi dey for bed but na im spirt go di plez. Kourt kon tok sey im mata na Satan dey disturb am or mek e bi sey shi don mad, dem kon tok sey shi go dey eat bread an water for eight days an ''uppenbar kykoplikt'' bikos shi dey wok on Sundays an shi dey uze Jesus, Holy Spirit an God nem wen shi dey du di tins. Dem Kon still kolet hol di wok wey hi dey du for im hand.

Wen dem judge di kase, plenti pipul kon sabi am wel wel as wuman wey im way no dey pure, Head of di chorch kon dey komplain sey plenti pipu dey go ci am for hep an dey du am lik sey shi bi god. In 1737, pesin wey dey as di chorch head kach am wit one pesin wey dey kom ci am, Beata Grupe, dem arest dia two, kon kari dem go wia pasto wey sta. Dem ask am question abaut kase wey shi get for di sekond time in 1738. Shi tok sey na im papa broda Gertrud Zakrisdotter (1647-1718 ) tich am, an shi read hau shi tek tok wen shi dey du di juju for kourt. Di kourt tok sey shi no dey du witch, but tel am wetin dem tok wen dem ask question for dat fest time. On 21 October 1738, dem purnish am wen dem tok set me shi dey eat onli bread an water for 12 days. Na Kajsatornet(Kajsa Tower) for Visby city wall. Dem tok sey Brita Biörn no kpai for late 1745, but nobodi no di year wey shi kpai. In 1760, for insaid parish register dem ci one old wuman nem wey don kpai, di pesin nem na Old Brita, an in 1765, pesin wey no get hosband nem wey bi Biörn nem dey insaid pipul wey don die, but nobodi no if Brita Biörn na one of dia two.

Som oda pipul wey live afta am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Shi get bon pikin wey bi boatswain Olaf Jönsson Lunda (1692-1773), wey mari Pernilla Larsesdotter (1715-1779). Im son pikin wey bi girl Greta Enderberg (1746-1831) an im great granpikin wey bi girl Gertrud Ahlgren(1782-1874), wey folo im mama way wey no pure for Gotland: dem sabi dia two as Hejnumskäringen for dia time as wuman wey dia way no dey pure.