Brigitta Lars Anderssons

From Wikipedia
Brigitta Lars Anderssons
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Fest nemBrigitta Chenj-am
Wok wey e dey duherbalist, cunning folk Chenj-am

Brigitta Lars Anderson's ( e kpai Afta 1551) or Birgitta Lass Anderson ("Brigitta, Wife of Lars Anderson") also kol Brigitta Andersdotter ("Brigitta gel-pikom of Anders) na Sweden wuman wey bi tradishonal native doktor an pesin way dey hep for palas. Na Brigitta bi di wuman doktor wey tekia of di pikin of King Gustav I of Sweden an e stil dey tekia of di Kween Margaret Leijonhufvud. Di Kween like Brigitta as e doktor na e bi nomba one doktor wey dey trit am.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di wok of Brigitta na to tekia of di king pikin-dem. Di pikin get dia own place wey dem dey stey an di place long rish atlit 1540. Di nem of di aria wey pikin-dem dey stey na Barnastugan (Pikin house). We no too no meni tins abaut di pipul wey wok at di palas dorin dat period wey Brigitta wok dia. Di onli tin wey we no bi sey Dis four wuman chuk eye for di king pikin-dem: Margareta, wey bi di kween korsin an nemsek. Di sekod wuman na Ingrid Amundsdotter wey bi widow an get mouth for di Palas. Di nomba three pesin na Ebba Eriksdotter Vasa an di last pesin bi Christina Gyllenstierna. Ebba Eriksdotter Vasa an Christiana Gyllenstierna dey luk afta di pikin-dem jost for smol time. Di Kween biliv in Brigitta wel wel dat e dey halao mek Brigitta tekia of e pikin wen e wan travu. Brigitta na jost hodinari pesin. Kween Margaret jost like am an e na pesin wey di kween mek as e pasonal pesin wey di kween dey diskuss tins wit. No bi onli sey di kween halao mek Brigitta dey tekia of e pikin-dem, e stil mek Brigitta dey kontro e biziness. For ezampul, wen di kween borow one pesin kol Anders Persson moni in 1545, na Brigitta e yuz as e finansha agent to kolet di moni bak.