Bob-Manuel Udokwu

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Bob-Manuel Obidimma Udokwu (bon 18 1968) na Naija aktor, direktor, produsa and politician. For 2014, I receive di Lifetime Achievement award for di 10th Africa Movie Academy Awards. Dem still nominate am for Best Actor in a supporting role for di 2013 Nollywood Movies Awards for i rol inside Adesuwa.

How i tak stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

I kom from Nkwelle-Ogidi, Idemmilli North LGA of Anambra State, Naija. Na Igbo man, I papa nem na Geoffrey Nwafor Udokwu and di nem of i mama na Ezelagbo Udokwu. Dem bon am for Enugu State. Na i bi di fourth pikin of i family of six pikin, na i bi di second son. I papa bon three boys and three girls.

Edukashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

I go St. Peters Primary School (now Hillside Primary School) for Coal Camp, Enugu, Enugu State for i elementari edukashon and Oraukwu Grammar School, Oraukwu,Anambra State for i secondari edukashon.I go University of Port Harcourt, Port Harcourt,Rivers State where i kolet Bachelors of Arts Degree in Theatre Arts. I kon go du I master's degree in Political Science with specialisation in International Relations from di University of Lagos, Lagos State. Na i bi di Student Association for di year 1989-1990.

Persona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Udokwu met I wife Cassandra Joseph when i dey du i masters digree program for di University of Lagos, when shi bi undagraduate for di University. Dem marri for February 19,2000. Dem don two pikin Elyon Chinaza(girl) and Marcus Garvey (boy). I nem i son, Garvey Udokwu afta di political leader, Marcus Garvey. Udokwu na Christian.

Fim wey i dey[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Living in Bondage
  • Rattlesnake
  • Karishika
  • The Key for Happiness
  • Black Maria
  • What a World
  • Heaven after Hell
  • A Time to Love
  • Cover Up
  • Endless Tears
  • Naked Sin
  • My Time
  • Home Apart
  • Games Men Play
  • Soul Engagement
  • Living in Bondage: Breaking Free