Blue Whale Challenge

From Wikipedia

Blue Whale (Russian: Синий кит, romanized: Siniy kit) wey som pipu stil sabi as "Blue Whale Challenge", na social netwok datin tins wey don dey sins 2016 wey dem tok sey dey for kontri. Na "game" e bi wey get wetin pipu wey wannpley am go du, pesin dey dia wey go tel dem wetin dem go du an na 50 days dem giv dem to du am, for stat dem no go wund diasef an final stej dem go tel di plays mek dem kil diasef.

"Blue Whale" fest dey popula wen one newspaper rait abaut am in May 2016 insaid Russian newspaper artiku Norvaya Gazeta wey link plenti smol pikin to kpai demsef ontop member of "F57" for di Russian base VK social network. Fear for beta wey to dey du tins to komot for Russia. Leta, dem no gree sey plenti smol pikin kpai bikos no evidence to pruf, plenti pipu dey tok sey pipu kpai for di game but dem neva ci enibodi wey don kpai.

Dey don ban di game for som kontris lik Egypt, Kenya an Pakistan. Plenti ogbonge pipu stil tok sey e go hard to stop di game.

Hau e tek stat[chenj-am | chenj-am for orijin]

Insaid November 2015, one Russian yung pesin rait du pisho kon rait for websait "nya bye" bifor e kpai imsef, dem kon tok abaut hau e tek kpai for intanet an grips, wey plenti pipu dey tok difren tori. Smol taim afta, Russian journalist Galina Mursaliyeva fest rait abaut "death group" insaid one artiku wey dem rait abaut for Russian newspaper Norvaya Gazeta in April 2016. Di atiku rait sey di "F57" grup for Russian social media site VK, wey don mek abaut 130 yung pipu kil demsef. Mursaliyeva's atiku wey dem rait, no bi evribodi gree ontop wetin dem tok bikos e no get beta pruf. Na one of di yung pesin wey kpai imsef papa chuz di nomba, e stil tok sey Russian workas wey dey find out tins dey insaid wetin dey kours yung pipu to kpai. Afta Evgeny Berg mek e own findings for Meduza, e tok sey e don rish 200 yung pipu wey kpai.

Dem Neva rili no wia di nem "Blue Whale", tek kom out. Som pipu tok sey na fom Russian rick band Lumen. Di song stat wit di som words lik Why scream / When no one hears / What we're talking about?" an stil get "huge blue whale" that "can't break the net." Som pipu biliv sey na bleachin dem dey tok abaut, wia whales jus dey waka enihau an kon kpai.

Plenti pipu bliv sey di game na abaut person wey stat am an peain wey wan pley. Dem dey holways giv pipu wey wan pley di game wetin dem go do. Fifty days wey dem go uze, dem go giv who wan pley sumtin for one day ("dem go wake up 4:30 am", kon luk horror fim) kon go wund diasef, wey go make who dey pley kil imsef for las day. One professor for Russian State Universities for di Humanities, Alexandra Arkhipova tok sey smol pikin wey no pas 12 and 14 years old dey di game.

Polis wornin[chenj-am | chenj-am for orijin]

Polis wey dey Russia don worn pipu abaut di game.

Polis for oda kontri sef don worn dia pipu bikos of di game, kontri like: Armenia, Australia, Brazil, France, India, New Zealand an di United Kingdom.