Bisi Akin-Alabi

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Bisi Akin-Alabi na one ogbonge Naija edukashon expert, social worker, administrator, technocrat plus including former special adviser on top education, science and technology mata to Senator Abiola Ajimobi, wey bi before before governor of Oyo state for inside Nigeria.

Early life and Education[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem born Bisi for Igbo-Ora, inside Oyo state,for Nigeria. Him papa be one naija paramedic and him mama bin come from Porto-Novo for Benin republic. Bisi bin attend Federal School of Arts and Science from where she waka go University of Lagos go get Bachelor of Science degree come join am with Master of Business administration wey she get from London South Bank University.

Him also get Postgraduate Certificate inside Education from Roehampton Institute for University of Surrey plus including Ph.D inside child development and humanities wey she get from London Graduate School. Shi bi fellow of many international bodies wey include International Chartered Management Consultants, Chartered Institute of Commerce of Nigeria (FCICN), Fellow of di Windsor Fellowship UK plus including United Kingdom Strategic Society.

For March 2001, Tony Blair wey bi British Prime Minister for dat time plus including his wife Cherie Blair bin honor Bisi Akin-Alabi for 10 Downing Street, London on top dat correct correct contribution wey shi don contribute to edukashon and childcare inside United Kingdom.

Career[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bisi bin teach science and mathematics for schools inside di United Kingdom for more dan twenty years. Na She be the founder founder of SchoolRun Academy plus including publisher of SchoolRun Magazine. Shi bin serve as a special adviser to Senator Abiola Ajimobi, di before before governor of Oyo state, Nigeria.

For 2017, Bisi Akin-Alabi carry one correct program wey dem call Oyo State Model Education System Interventions(OYOMESI)come land for Oyo state. Na this ogbonge program come make United Nations Educational, Scientific and Cultural Organisation (UNESCO) come join Ibadan as learning city.