Binta Ayo Mogaji

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Binta Ayo Mogaji na popula Naija aktress wey don try for akting. According to Shaibu Husseini, Mogaji don dey part of at least 800 fims, television sho and theater producshon.

Ha persona life tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Binta bon 1964, shi kom from Agbo-Ile, Ibadan. Ha papa na Islamic cleric an ha mama na edukashon administrator. In 2006, shi marri ritayad football Playa and physiotherapist Victor Ayodele Oduleye. Shi bin dey romantic relationship with popula aktor Jibola Dabo and dey bon one pikin wey bi boy

Ha Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di fest fim wey shi akt na Mojere, wey bi Yoruba fim. Dem give ha best actress at di REEL Awards. In 2015 Mogaji tok sey na lie say fim makers prefer young aktors and aktress in Nollywood. Shi explain am sey their reason no fit bí bikos of professionalism, bikos nothing wey young aktor dey do wey di old ones no fit do. In 2018 di interview with di Punch, Mogaji explain sey shi never akt semi-nude or kiss inside fim throughout DI and time wey shi take bí aktress. Shi tok sey produsas know di kín rol wey shi fit pla.

Fim wey shi du[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Kasanova (2019)
  • Pasito Deinde (2005)
  • Àkóbí Gómìnà 2 (2002)
  • Eni Eleni 2 (2005)
  • Nowhere to be Found
  • Why Worry the Barber?
  • Sergeant Okoro
  • Igbalandogi
  • Mojere
  • Owo Blow
  • Ti Oluwa Nile (1992)
  • Motherhood
  • Owo Ale
  • Ileke
  • Ojuju
  • Ile Olorogun