Berit Skjefte

From Wikipedia

Berit Tørrisdatter Skjefte Pynten (dey bon am araund 1809 an e kpai in 1899) na one wuman wey kom from Norway wey sabi play one tradishonal Norway muzik instrumet wey bi like ginta kol langeleik.Pipul stil no Berit Skjefte as Berit på Pynte or Berit Pynte. Skjefte kom from Vestre Slidre wey de Valdres aria. E bikom popular wel wel for Norway bikos of how e tek sabi pafom in front of pipul an how e dey yuz babi wey dey dans pafom. infat, Na from Skjefte paformas di two muzik komposa Edvard Grieg an Ludvig Mathias Lindeman dey get hidiya or inspireshon to du dia wok. Dey kip three instrumet-dem wey Skjefte dey yuz pafom inside Ringve Museum wey de Trondheim.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Vestre Slidres dey bon Berit Tørrisdatter araund 1809. Skjefte papa nem na Tørris Toresen ( dey bon am in 1772) an e mama nem na Marit Tørris (dey bon am in 1778 an e nem bifor e mari na Gjermundsdatter). Skjefte papa na souja an farma. Na inside Gryte farm e tek gro up. Skjefte mari Andris Andrissen Skjefte ( dey bon am in 1804). E hosband wok na farma an pesin wey dey menshon land. One gossip wey dey go raund dat time bi sey, Skjefte an e hosband yuz just five pot of ogogoro tek kolet di house wey de klose to main road to Vestlandet. Di nem of di house na Pynten.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen Skjefte go find hanima for bush wey dey go chop, Skjefte go dey house dey kolet mini from pipul wey wan am to play di langeleik instrumet for dem. Di house Pynten na beta restin ples for meni Norway pipul an pipul wey fourin pipul wey dey travul on di main road to Bergen. Skjefte get bizness sense bikos e sabi to mek motor driva to stop an allow di pasenja to kom an enjoi di muzik "Berit på Pynte".