Benneth Nwankwo

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Benneth Nwankwo na Naija documentary photographer and fim direktor. I kom from Orumba North Local Government Area, Anambra state,Naija. Pipu sabi sey im dey direkt high skul web miniseries, Like Filtered Water and 2022 Naija Dance Drama TV Series, Breakout.

Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Nwankwo don direkt som contemporary fims,including like Filtered Water(2021), Abuse Of Rights (2021), This Is My Story (2020) and Dreams and Survival (2020). For April 2021, Dem tell am sey im go direkt one fim wey i nem bi A Place Between Colour. For January 2020 i host di fest indigenous exhibition in Anambra State. Di event wey i nem bi "Akaraka: Anambra Through A Lens" di event attract lovers of Art and entertainment from different part of di kontri and even South East Naija. Di Wey feature live performances, to sho pipu di potential to use dat one bring moni enta di state oda photographers wey kom na Uju Egwin, Obiora Okoye, and Michael Ike.Di bifor bifor Commissioner for Youth and Creative Economy in Anambra State, Afam Mbanefo, praise Benneth Nwankwo as im dey use photograph tell di tori of di state. In October 2017, Benneth Nwankwo publish di photo of a boy hawking groundnut for Anambra state. Di photo dey everywhere for internet and meni Naija newspaper publish am too. Meni pipu including 2017 Anambra State Gubernatorial Candidate, Okeke Chika Jerry, sho interest to help di boy "Sunday Nweke" to finish i edukashon.

Endorsement[chenj-am | chenj-am for orijin]

For October 2020, one Naija real estate compani, De-GraceLand Home Consults, sign Benneth Nwankwo with Chioma Okonkwo (bifor bifor Miss Impact Anambra) as brand ambassadors. Di contract last for one year.

Books[chenj-am | chenj-am for orijin]

How To Write About Nigeria : A Collection of Satirical Commentaries that Attempts To Shed Light On The Nigerian Condition

Fim wey i dey[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Dreamscape And Survival (2020)
  • The Irreplaceable (2020)
  • The Little Things That Matters (2020)
  • This Is My Story (2020)
  • Abuse Of Rights (2020)
  • Hustler (2021)
  • The Web (2020)
  • Like Filtered Water - The Series (2021)
  • A Place Between Colours (2021)