Bella Shmurda

From Wikipedia

Abiola Ahmed Akinbiyi (dem bon am for 27 January 1996), plenti pipul sabi am for im wok as Bella Shumurda, na Naija singa. Im song Vision 2020 mek meni sabi im wok wel Wel.

Hau e tek stat life an im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bella Shmurda na nem wey plenti pipul sabi afta e sing "'Vision 2020"' an stil du di remix wit Olamide. E du plenti song insaid 2020, one of dem na "Cash App" e sing wit Zlatan Ibile. Im nem dey insaid pipul went fit win Headies Awod of next Rated 2020.

Insaid 2020, Bella Shmurda win Next Rated Awod an an Street Musik of di year for City People Entertainment Awards, im nem stil dey insaid pipul wey fit win "Revelation of the Year" awod for 2020.

For 2021, Bella Shmurda nem dey insaid pipul wey fit win "Next Rated" awod for di Headies. For June 2021, im song,Cash APP wey e sing wit Zlatan dey for Most played song- Street Pop for NET Honours.

Na onli Bella bi di Afrika artist wey dey YouTube program, wey bi YouTube Foundry Programme insaid 2021.

For June 10 2021, Bella let pipul sabi say im sekond EP High Tension vol 2, go komot on July 2021, na for im Instagram e tek let pipul no.

Bella fest du sho for 02 Arena insaid United Kingdom, for Wizkid's Made In Lagos concert insaid November 2021.

Som hep wey e du[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bella ci one smol pikin wey dey sing Olamide's "Triumphant" song wey Bella sef sing insaid. Bella kon tok sey e go send di pikin go skol.

Wen Bella dey du im Birthday for January 2022, e tok sey e go give plenti pipul wey no too get food.

Som of im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

'EPs

.High Tension (2020)

.High Tension (2021)

Singles


Singles[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Title Producer Album
2018 "Vision 2020" ID Cabasa
2019 "Only You" Bylinx
2020 "Colodia Drive us" Bella Shmurda – "Colodia Drive Us" "Cash App" (featuring [[Zlatan (musician)|Zlatan
2021 title=Bella Shmurda – Rush (Moving Fast)|
Bella Shmurda – World SB Non-album single
“So Cold” (featuring Popcaan) Non-album single