Bedtime story

From Wikipedia
A father reading his daughter a bedtime story: Madeline by Ludwig Bemelmans

Bedtime tori na tradishonal ways of tellin tori wey pikin go dey hie am as dem dey bed wan go slip. Pipo konsida bedtime tori as one of di mejo tins wey sopos de for evri famili. Na Louise Chandler Moulton fest yuz di word bedtime tori for di buk "Bed-time Story" One skolar wey e nem na Robin Bernstein risach how dis prosess tek start in di 19 senturi an dis proses kom dey popula in di 20 senturi. Bikos of bed-time tori, Meni buk kom de wey get pikshon wey pikin fit fit enjoi. Bed-time tori stil kom mek smol pikin dey get dia bed-room.

Wen pipo dey rid bed-time tori for dia smol pikin, na both di peret an di pikin dey gain. For di pikin, e brain go dey sharp more more, e go sabi langwej wel wel, an di pikin go sabi yuz e brain tink fast fast. Bikos peret dey spend time with dia pikin for bed time, dis one dey mek dia frendship strong more more.

Wen pikin stil dey smol, dia brain fit kolet meni informensho an dis tori wey dia peret dey tell me fit helep dem get beta karata wey dem go dey folo. We still fit yuz bed-time tori tek tish smol pikin.some karata like: mek pesin dey show piti for odas, mek pesin no dey greedi, an mek pesin dey kontro imsef. Bikos smol pikin nashoralli fit show all dis kind karata wen dem don esperiens. Bedtime tori fit helep pikin-dem emajin how oda pipo dey feel. Dem fit stil yuz bedtime tori to esplen difikut topik like di mini of death or wetin fit mek one tribe no like oda tribe.

Pipo wen don grow sef get dia own bedtime tori wey dey mek dem fit slip. Dis one fit de in form of redio k-set or buk-dem.

For westa kolsho[chenj-am | chenj-am for orijin]

For westa kolsho, meni peret dey rid bedtime tori for dat di pikin go fit get beta slip. Dis habit, to dey rid tori for pikin from peret is gud bikos e dey mek peret an pikin frendship de tight.