Bassirou DiomayeDiakhar Faye

From Wikipedia

Bassirou DiomayeDiakhar Faye (dem bon am on 25 March 1980), dem sabi am wel as Diomaye, na Senagalese politishan an bifor bifor tax inspekto wey don sarf as di 5th an ko rent President of Senegal sins 2024. Na im bi di general seketry of di parti wey don skata PASTEF an win di 2024 Senagalese Presidenshial eleshon afta dem komot Ousmane Sonko, wey e leta mek am di Prime Minista.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am on 25 March 1980 in Ndiaganio, wey dey western department of M'bour, Senegal. Im papa na Samba Faye, wey bi memba of di Socialist Party of Senegal . E get sista sef. Faye granpapa faight for di Free French di taim of World War II as solja insaid di Troupes colonies an dey put am for jail wen e wan trai opun skul for Ndianganao wey Faye leta go.

Skul an hau e tek stat wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

E go primari skul for im vilej an leta go midu an high skul for M'bour. E get im masta digre in lor fom Dakar's Cheikh Anta Diop University. E stil go National Skul of Administrashon of Senegal (ENA) an di magistracy in 2004. Afta e du graduation, Faye chuz to bi tax inspekto insaid Tax an Estate department, wia e tek bi frend wit Ousmane Sonko, wey dia two go sem skul.

pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Faye Mari two waif: Marie Khone Faye and Absa Faye. Marie Khone get four pikin for im hosband : 3 boys an one girl. E Neva get eni pikin wit Absa. Faye mari Marie insaid 2009 an Absa insaid 2023. Akordin to do tins wey e tok sey e get Wen e dey du Presidenshial campaign in 2024, Faye get hauz for Dakar, an land outsaid di capital an for Ndianganao. E stil get $6,000 for im bank akount. Faye an Ousmane Tanko na klose frend, wey mek am nem one of im pikin Ousmane. Na fom vilej e tek uze plenti taim, wey mek am sabi di vilej wel wel an na muslim e bi.