Barbara Barnard Smith

From Wikipedia

Barbara Barnard Smith(June 8,1920-July 3,2021)na one Amerika enthnomusicologist wey stat and difelop di fild of enthnomusicology for Yunifasiti of Hawaii. Shi bi Profeso Emeritus of music for di Yunifasiti.Aldo dem emploi am to dey tich Piano and Western muzik;shi biliv sey dis kind tin go distroi indigenousHawai'ian and Pasifik Islandkulsho dem wey bi ancestral eritej of most of di student dem.Shi kom stat to dey len abaut hau stodi hau to tich an hau to rait abaut lokal indigenous Muzik and dans. Barbara Barnard Smith kontiniu to advais PhD. student dem on top dia dissertafions on til di time wey shi dai for 101 yias of age.Na shi bi di gret grand girl pikin of William Dewey Hobson,wey bi pipul know as di fada of Ventura County,California.Smith stat im karia for di UH Manoa for 1949 to dey tich Piano and muzik tiori,afta shi don get Masta Digri for muzik litresho from di Eastman Skul of muzik. For October 1972,shi edit one speshal edishon of di muzik Edukeshon Jonal to mek ethnomusicology go hai pas speshalis dem.