Balarabe Musa

From Wikipedia

Dem bon Abdulkadir Balarabe Musa foh (21 August 1936 - 11 November 2020) an na politishian foh Nigeria wey dem elekt as bifor bifor govnor foh Kaduna Stet, na hold ofis foh Nigeria sekond repoblik, from October 1979 go rish 23 June 1981 wen dey impish am komot foh ofis. Foh di nomba four Nigeria repoblik na him bi leeda foh Conference of Nigerian Political Parties (CNPP),wey bi kombineshon of parti wey no bi e parti dem.

E Background[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Musa foh 21 August 1936 foh Kaya, Kaduna stet. E stodi foh Zaria Middle School from 1947 go rish 1952, and for di institute of Administration, Zaria from 1952 go rish 1953. Im bi akount klak foh 1953 go rosh 1955, and e wok as skul Tisha foh 1955 go rish 1960. He wok as maneja foh difrent difrent akount mata foh di period of 1960 go rish 1975, dat time, im dey stodi foh difrent difrent kolej dem foh London tu fit gain adishonal kwolifikashon dem.

Wen E bi Govnor foh Kaduna Stet[chenj-am | chenj-am for orijin]

Foh 1979, dem elekt Musa as govnor foh Kaduna Stet onda di platfom wey bi di People Redemption Party wey bi sey na Aminu Kano bi di founda of di parti, wit oda pipul like Abubakar Rimi, Sabo Bakin Zuwo, Abdullahi Aliyu Sumaila, Yusufu Bala Usman, Uche Chukwumerije, and Michael Imoudu, Chinua Achebe, Sule Lamido. Di chalenj wey di National Party of Nigeria (NPN) chanlenj am no kom dey sosesful. Di parti wey e dey don fest bi part of di PPP parti wey get konekshon wey dey agenst NPN, e kom leta withdraw small small. Di Kaduna Stet House of Assembly wey bi sey na NPN memba dominet di house, dey kom mek progres foh e matta as e bi govnor. E no kom fit fom eni kabinet bikos e no gri to nominet NPN memba dem and di house no gri aproof his kandidet dem. Di house kom impeach am foh June 1981, wey mek am bi di fest Stet govnor wey dey komot from govnor seat.

Wen di Kaduna Stet klob wey dey play one game wey dem dey call polo invite Musa no gri go, "e tok sey him no sabi play di game, sey polo game na for oyinbo pipul foh pipul and na foh pipul wey get pawa and foh pipul wey get money". Musa kom tok sey dem komot am from di govnor seat bikos im bi dey plan am to mek di stet open som small small indostri and di one dem wey big small, and e fit mek di NPN memba dem no get di chans to stat dia own kompani dem. He kom stat di kompani dem wey bi sey na stet get dem, e leta close down di kompani dem bikos di kompani dem no bring profit.