Badamasi

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Badamasi portrait of a General an na tru live tori of forma naija head of state wey e nem na Ibrahim Badamasi Babangida (IBB).Na Obi Emelonye bi daireto an star Eyinna Nwigwe na im pley di lid role as Babangida for di fim. Di fim na di fest Nollywood political biopic.

Tori Abaut Di Fim

Badamasi kari tori of Babangida from wen e dey vilej of wushishi for Northern Nigeria to di time wey e join army an time wey e kom bi Nigeria military head of state. Badamasi stil tel us abaut tinz wey hapun for Babangida laif even di wan wey hapun for Nigeria Civil war,dat time Babangida wound as e try mek e save im kolikwe during dat war. Badamasi stil tok abaut di military coup dem an how dem tel council di June 1993 presidential elecshon ol did tori dey for di fim.


Cast

Edit

Enyinna Nwigwe as Babangida
Charles Inojie
Sani Danja
Yakubu Mohammed
Okey Bakassi
Kalu Ikeagwu
Julius Agwu
Erick Didie

Wen Dem Produce an Rilise Di Fim

Di produshon of Badamasi stat for 2017 di Fim tori na old one na since 1980/1990s naija an dem shot di fim for Lagos,Minna,Abuja an University of Nigeria (UNN)Msukka. Di fim daireto tel pulse Nigeria for intaview sey e tel am 4 yeaz For am to fit change di mind of Babangida mek e fit allow am di di fim. Bifo dem bin wan rilise di fim for 29 Novemba 2019 but Nikos of som pawaful pipul wey no want mek di fim go round di fim kom delay kom out but dia concern na set di fim fit whitewash Babangida tori as di persin wey no dey responsible for di June 1993 Presidential elecshon. Di fest luk trailer dem rilise for semptemba 2019 na for cineworld 02 Arena dem fest watch di Badamasi fim for south London for 12 June 2021. One riview for di Guardian dem prez di fim for gud producshon an dem giv attenshon to details wey mek am tok sey "Di fim no bi laik Nollywood" an e stil dey watch oda fim dem wey Obi Emelonye di laik Heart 2 Heart, The Mirror Boy, Last flight to Abuja an Onye OZI.

Awards An Nominashon

Caption text
Year Award Category Recipient Result Ref
2020 African movie Academy Awards Best Actor in a leading Role Enyinna Nwigwe Nominated [6]
2020 African Movie Academy Awards Best Visual Effects Badamasi Nominated [6]
2021 Best of Nollywood Awards Best Actor in a leading Role (English) Eyinna Nwigwe pending [7]
2021 Best of Nollywood Awards Best Actor in a supporting Role (English) Sank Danja pending [7]
2021 Best Nollywood Awards Movie with the Best production Design Badamasi pending [7]
2021 Best Nollywood Awards Movie with the Best Special Effect Badamasi pending [7]
2021 Best Nollywood Awards Movie with the Best Cinematography Badamasi Pending [7]