Baba Ahmadou Danpullo

From Wikipedia
Baba Ahmadou Danpullo
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromKamerun Chenj-am
Fest nemAhmadou Chenj-am
Wen dem bon am20. century Chenj-am
Ples wey dem bon amKamerun Chenj-am
Wok wey e dey dubusiness magnate Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am

Baba Ahmadou Danpullo(Dem bon am for 1959) na biznes man fom Cameroon. Na im get mini pas for french kontr wey dey Afrika Sahara akordin to wetin Forbes Afrika 2019.

Tori abaut im life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Hau e tek gro an stat life Baba Ahmadou Danpullo na muslim. E liv wit im papa an mama for smol, di fest wok wey e du na truck wok an e get smol smol tins wey e dey sel. E trai get lincense to dey kari tins lik rice an flour fom oda kontri, wey mek am kolet loan fom bank, an stat to dey kari rice an flour fom oda kontris.

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Baba dey insaid ogbonge pipu wey mek Cameroon get beta ekonomi. Dem stil sabi am for im wok as pesin wey dey sel land an rent land for pipu, dem sabi as pesin wey dey du food tins, dem stil sabi am as pesin wey dey du telecomunikashon an transport wok. E dey insaid pipu wey get Nexttel, e dey kontrol 30% of di share fom im kompini, Bastinvet Cameroon (BestCam). Di wok wey Dem uze sabi am pas na as e dey plant tea of Ndawara, in di North West syd, wey dem dey kari go anoda kontri go sel. E get televishon stashon wey bi DBS (Danpullo Broadcasting System).

E get share for pobik kompinis lik Sodekoton, di Cameroon Airport (ADC), an na im buy di tea kompini; Cameroon Tea Estate (CTE). Baba stil get some oda tins wey e dey du fom difren kompini, dem don kol im nem insaid pipu wey dey du land biznes for plea lik, Nigeria, France, Cape Town, Switzerland, pipu Tok sey e get two big ples wey dem dey sel tins for South Afrika.

Awod an hau dem tek sabi am[chenj-am | chenj-am for orijin]

E don dey for Afrika edishon of di Amerika magazine Forbes, as di pesin wey get mini pas for French Afrika kontri wey dey south of di Sahara, Dem valu am at abaut 547 Billion fom FCFA.

Insaid 2019, Baba Ahmadou Danpullo dash politika parti, DPRK 100 million francs Cfa.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Baba Ahmed Danpullo Africa's discreet business magnet. World Finance magazine. Retrieved November 9 2023.

2. Cameroon Richest man Baba Ahmadou Danpullo brings MTN to his knees. August 18 2023, Billioare Africa. Retrieved November 9 2023.