Ayo Adesanya

From Wikipedia

Ayo Adesanya (bon 11 August 1969) shi bi Naija fim aktress, direktor and produsa. Ayo Adesanya dey du Yoruba and Inglish langwej fim.

How shi tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ayo Adesanya kom from Ijagun, Ijebu for Ogun Stet Southwest Naija. Ayo Adesanya go St Anne's Skool for Ibadan, di kapita of Oyo stet, where shi finish ha primari and sekondri Skool edukashon and obtained both ha First School Leaving Satifikate and West African Sinior School Satifikate. She later go Universiti of Ibadan where shi obtained a bachelor's digree in Mass communication.

Ha Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ayo Adesanya stat ha Karia in 1986 afta shi complet di National Youth Service Scheme (NYSC) In 1996, Ayo Adesanya join di Naija fim industri (Nollywood) professionali and shi stat ha professiona akting karia, shi appear on television for DI fest time on Tunji Bamishigbin's soap opera wey di nem bi Palace. Ayo Adesanya lata joined di Yoruba-language film industri, where shi don feature, produs and direkt meni meni fim, Ayo Adesanya dey du English-languwej fim tu.

Ha persona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ayo Adesanya bin marri Goriola Hassan but di marriage scatta. Shi bon one pikin wey bi boy