Aso Oke

From Wikipedia

Aso Oke farik,(Yoruba:aṣọ òkè,if dem korl am e dey saund like say na "ah-shaw-okey") na Yoruba pipul, of west Afrika klot wey dem yuz hand tek wiv. Most of di time na men and wuman dem dey wiv dis fabrik and dem dey yuz am mek men dem gaun, wey dem dey korl Agbada and kap wey dem dey korl fila and dem ivun dey yuz am mek wuman dem rapa wey dem dey korl Iro and di head-tai wey dem dey korl gele.

E dey plenti for Kogi, Ondo, Oyo, Ogun, Ekiti, Lagos, and Osun stet dem for west of Naijá and Ajase for saut-west of Benin Republik. As dem dey mek di klot for oldin days, naso dem stil dey doam tili today but dem don stat to dey yuz tekinologi tek ridus hau di klot thik and hevi.Dem don stat to dey yuz fabrik wey no thik tek mek Aso Oke and dis thin don mek am dey easi to yuz Aso Oke mek sinpu-sinpu klot wey pesin fit to wie komot as e bi sey di orijina Aso Oke no dey easi to mek som kain klot. Pipul wey dey mek aso oke don dey add niu-niu dizain dem like flawa dizain and som oda thins wey dem fit yuz konputa do.E bi like sey na from tradishonal stori dem get meni of dis dizain dem. Sanyan