Argot

From Wikipedia

Cant na jargon or langwej for one grup dem dey uze am to komot pesin for di grup or Wen dem no wan mek anoda pesin wey no dey di grup ear wetin dem dey tok. Dem fit stil kol am langwej wey dem dey uze confuse pipu ABI sikret langwej. Dem no dey uze am evritaim lik day. Richard Rorty tok abaut am Cant say Samuel Johnson tek tok am sey na wetin pipu tok for mouth wey dem no tink bifor dem tok am.

Hau e tek stat[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na two wey dem tek tok abaut di word cant: 1. For langwej, dem meaning kom fom Irish word caint (spellin wey don tay cainnt), tok, abi Scottish Gaelic cainnt. Dem ci am as wetin dey popular insaid som grup for Ireland an Scotland, wey kom fom Ireland/Scottish Gaelic an English. Wey dey uze mix langwej. Pesin no fit no difren cant wey dey (Scottish/Irish) bikos dem resembu. Irish pipu dey dia own "can't". Pipu wey dey tok am fom di Irish travu side dem sabi am as Gammon, an di langwej kommuniti sabi am as shelta.

Pipu wey no dey for Gaelic circles, dem ci di shot meaning fom Latin cantāre, to sing, wit norma French canter. Di histri for dis langwej, dem fest ci am as wetin pipu dey tok wen dem wan shout for somtin, dem uze am for sumtaim Insaid di 12th an 15th centuris. Small taim e don bi wetin beggars an kriminal dey uze.

Argot[chenj-am | chenj-am for orijin]

Argot English: /ˈɑːrɡoʊ/; from French argot [aʁɡo] 'slang') na langwej wey difren grup dey uze to tek no let pipu fom outsaid ear wetin dem dey tok. Di word argot, mean hau dem dey uze tok for wok, pley, wey stil mean di sem tin wit jargon.

Insaid 1962 novel Les Misérables, Victor Hugo tok abaut jargon sey na langwej of di dark an langwej wey dey surprise pipu.

Di taim wey dem rememba Wen dey uze argot na for 1628 dokumet. Di wod kom out fom les agortiers, wey dem giv a grup wey dey thief thief pipu tins. Wen dem chek am wel argot na propa langwej. Di kain langwej no dey popula bikos e get som oda popula word insaid. Dem fit uze Cant an argot for sem tin. For ezampu, verlan an louchében na argot word.

Ezampus[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adurgari, fom Afghanistan

Agbirigba, fom Nigeria

Äynu, fom China

Back slang, fom London, United Kingdom

Banjački, fom Serbia

Barallete, fom Galicia, Spain

Bargoens, fom di Netherlands

Bron from León an Asturias, Spain

Beurla Reagaird, a Gaelic-based cant uze by Highland Travula kommunity in Scotland

Boontling fom California

Caló (Chicano), fom di US/Mexican border

Cockney Rhyming Slang, fom London, United Kingdom

Engsh, fom Kenya

Fala dos arxinas, fom Galicia, Spain

Fenya fom Russia

Gacería, fom Spain

Gayle langwej, from South Afrikan gay kolsho

Gender transposishon

Germanía, fom Spain

Grypsera, fom Poland

Gumuțeasca, fom Romania

Gyaru-moji, fom Japan

Hijra Farsi, fom South Asia, uze by di hijra an kothi subcultures (tradishonal indigenous approximate analogues to LGBT subcultures)

IsiNgqumo, fom South Afrika an Zimbabwe

Iyaric, fom Jamaica, uze by adherents of Rastafari

Javanais, fom France

Jejemon, fom the Philippines

Jeringonza, fom Spain

Joual, fom Quebec French

Kaliarda, from Greek, uze by LGBT kommunity.

Klezmer-loshn, fom Eastern Europe

Korean ginseng-harvester's cant, fom Korea

Leet (or 1337 tok), fom intanet kolsho

Louchébem, fom France

Lóxoro, fom Peru

Lubunca, fom Turkey, uze by LGBT kommunity.

Lunfardo, fom Argentina an Uruguay

Martian langwej, to reples Chinese karacta

Meshterski, fom Bulgaria

Miguxês, fom di emo, hipster subcultures of yung netizens in Brazil

Minderico, a sociolect or a secret langwej wey by tailors and traders in Mindedey tok for Portugal.

Nadsat, a fictional argot

Nihali, fom India

Nyōbō kotoba, fom Japan

Padonkaffsky jargon (or Olbanian) rom Runet, Russia

Pig Latin

Pitkernese

Podaná, fom Greece

Pajubá, fom Brazil na word of di gay subculture wey uze Afrika or Afrika-soundin words as slang, borrow fom di Afro-Brazilian religions

Polari, na general word for a difren but no popula grup of words uze by aktors, circus and fairground showmen, gay subculture, kriminal (kriminasl, ashewo).

Rotvælsk, fom Denmark

Rotwelsch, fom Germany

Rövarspråket, fom Sweden

Šatrovački, fom di forma Yugoslavia

Scottish Cant, a taip of Scots an Romani uze by di Lowland Romani people in Scotland, United Kingdom

Shelta, fom di Irish Travellers kommuniti in Ireland Sheng fom Kenya

Spasell, fom Italy

Swardspeak (or Bekimon, or Bekinese), fom di Philippines

Thieves' cant (or peddler's French, or St Giles' Greek), fom di United Kingdom

Tōgo, fom Japan (a bak slang)

Totoiana, fom Romania

Tsotsitaal, fom South Africa

Tutnese, fom di United States

Verlan, fom France

Xíriga, from Asturias, Spain

Zargari.