Apotropaic magic

From Wikipedia
Apotropaic magic
Subclass ofmagic Chenj-am

Apotropaic magic (from Greek αποτρέπειν "to komot somtin") or magik wey dem dey uze protet somtin, na majik wey dem dey uze poshu bad tins, abi wey dem dey uze komot bad eye for pesin bodi. Apotropaic na pipu wey dey lik tradishonal tins dey du am, abi wey lik to dey get beta tins juju.

Objects[chenj-am | chenj-am for orijin]

Old Egypt

Apotropaic majik na wetin old Egypt wey nier East an old Egypt dey du. Dem dey uze am dey komot bad tins for pipu bodi bikos dem biliv say bad eye or tins dey folo pesin. Old Egypt pipu dey du di ritual for hauz ( no bi for temple), dem dey du am wit Heka. Di two as spirit wey dem dey kol for pesin bodi na hippotamus, Tawaret, an lion spirit, (Bes wey dem get fom apotropaic short god, Aha, wey plenti pipu sabi as faighta).

Dem dey uze tins folo di God tok, one of dem wey pipu sabi wel na ivory apotropaic wand, dem sabi am wel for Middle Kingdom (ca. 1550 - 1069 BCE). Dem dey holways uze am dey porshu bad spirit for mama wey get belle an pikin bodi, an dey dem lik do am wit sun spirit.

Som oda tins wey dem lik dey wear mek Pipu ci na gods lik Tawaret. Dem dey uze water wel wel Wen dem dey du di spirit tins, dem dey holways put am for pesin wey dem wan mek Di spirit wok on am bodi. Leta leta (wen Egypt kom onda Greek), Stele an Horus dey du tins lik Tawaret own, dem go out water for pesin bodi, kon leta tel di pesin mek e drink am.

Old Greek

Di old Greek get objet wey dey uze as symbols, wit difren nems, lik apotropaia, probaskania, periammata, periapta and profylaktika. Di Greek dey du sacrifice for gods, ( ἀποτρόπαιοι θεοί, apotropaioi theoi), chthonic gods, an pipu wey dey komot di spirit for dia bodi. Dem dey holways wear somtin for hand to dey uze am kova mama an pikin wey get belle. Greek pipu dey holways juju pesin for dia hauz to tek hep dem dey komot bad eyes an bad spirit komot for dia bodi. Dem dey uze grasshopper som taims Wen dem dey du di sacrifice.

Anoda way dem dey uze du sacrifice na to dey fold dia cloth.

Old Greek dey tel bois mek e du lik girls to tek kova dem fom bad eyes.

Kross[chenj-am | chenj-am for orijin]

Insaid Ireland, dem dey holways uze kross on At Brigid's day, dem dey hang am ontop door an windows to tek kova hauz fom fire, thunder, an evil spirits. Insaid Southern Ireland, Samhain dey holways uze kross an stick wey dem dey kol 'parshall' abi 'pashell', wey dem dey uze for dormot to komot bad luck, sicknes an witchcraft.

Eyes[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem dey holways paint dia eyes to komot bad evil eye for dia bodi. Dem paint apotropaic eye ontop Greek drink, dem kol am kylikes (eyes-kops) fom di 6th century BCE up til di end of klasika period. Dem paint eye on top drink, bikos dem no wan mek bad spirit enta di maut Wen dem dey drink. Dem dey paint fishing boat sef an wetin dem dey uze drive am. Turkish airlines, Fly Air, uze di symbol nazar boncugu (nazar bonjuk) on top one hand of di aeroplane. Di apotropaic Yiddish wods, קיין עין הרע, kain ein horeh, 'no evil eye' (in todey Hebrew, בלי עין הרע, bli ein ha'ra), mean sey, "knock ontop wood."

Faces[chenj-am | chenj-am for orijin]

Insaid old Greeks, pisho wey dem dey uze Pas to komot evil eye na Gorgon, wey dem fit kol di head nau Gorgonian, Wey bi big eyes and tongues. Di ful pisho dey sho two lion wey bi female. Di Gorgon head dey for aegis an pat of Athena. Pipu biliv sey dormot an window of a hauz na wia bad spirit fit Pas enta. For olden days Greek, grostegue wey dey lik cap na im dem du for door, so dat e go save dem for fire. Leta on, som chorch an big hauz dey du somtin wey go porshu bad spirit fom dia plez.