Antoine Griezmann
Overviu
[chenj-am | chenj-am for orijin]Antoine Griezmann[1] (dem born am for 21 March, 1991) na french profeshonal futbola wey dey play as a forward and attackin midfielder for La Liga club Atletico Madrid. Dem tok say na wan of di best players of his time, he don win many trofis and awards for club and contry includin di 2018 FIFA Men's World Cup wit France and di 2018 UEFA Europa Lig wit Atletico Madrid.[2]
Early Laif
[chenj-am | chenj-am for orijin]Antoine Griezmann[3] dem born am for 21 March 1991[4] for community wey dem dey call Mâcon inside the dipatment of Saône-et-Loire. Im fada, Alain Griezmann, na town councillor,[5] wey im people na originally German pipul. E get dis German ancestor, wey dem dey call Emmerich, wey japa go France from Münster for di early 19th cenchury and wey be basket meka.[6][7] Dier family surname na originally "Griesmann" dey been dey spell am, bifo dey come change am to "Griezmann".[8] His mother, Isabelle Lopes, na forma hospital staff memba wey supervise di cleanin team, she get Portugiz pipul blood, and her papa Amaro Lopes na a Portugiz footballer for Paços de Ferreira.[5] Amaro Lopes japa comot from Portugal to France wit his waif Carolina to go work for construction job in 1957, where dem born Isabelle, and he daid in 1992 wen his grandson na still small pikin wey im be.[5] Wen he be pikin, Griezmann dey like go Paços de Ferreira, Portugal, as di place where he been like to dey spend his holiadys.[5]
Cariya
[chenj-am | chenj-am for orijin]Early Cariya
[chenj-am | chenj-am for orijin]Griezmann begin his career wen he start to dey play for di club wey dey im hometowm UF Mâconnais.[9] Wail he been dey dere, he start to dey do several trayals wit plenty plenty profeshional clubs, includin Lyon, the club he been dey fan wen he be small child, to see if he go fit enta in one of their youth academies, but dey tell am mek he go, say dem no go chuz am bicus di clubs no like am as he dey small.[9] In 2005, as he dey on trayal wit Montpellier, Griezmann been play friendly match against di yut academy of Paris Saint-Germain in Paris, and e mek several clubs start to dey eye am, especially Spanish club Real Sociedad, who send scouts go attend di event. Afta di match, di club's dier officials wey dey attend the match offered Griezmann a one-week trayal in San Sebastián, which he accepted. Dey been later offer him a second-week mek he stay at di club. Di club den contact his parents and formally offer the player, Giezmann, a youth contract. Initial gra gra and worry worry mek Griezmann's parents no want have dier son move to Spain, but dey been later allow him to mek di move to travel go Spain afta di club tell dem say mek dem no fear say dey go gud care or dier child and notin go do am.[9][10]
Real Sociedad
[chenj-am | chenj-am for orijin]Atletico Madrid
[chenj-am | chenj-am for orijin]Barcelona
[chenj-am | chenj-am for orijin]Loan to Atletico Madrid
[chenj-am | chenj-am for orijin]Referencis
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ Tranfermarkt: Antoine Griezmann's Player Profail
- ↑ Soccerway: Antoine Griezmann Player Profail
- ↑ "Acta del Partido celebrado el 11 de mayo de 2011, en San Sebastián" [Minutes of the Match held on 11 May 2011, in San Sebastián] (in Spánish Lángwej). Royal Spanish Football Federation. Archived from the original on 19 April 2021. Retrieved 14 June 2019.
- ↑ "Antoine Griezmann". EU-Football.info. 26 June 2016. Retrieved 26 June 2016.
- ↑ 5.0 5.1 5.2 5.3 Alvarenga, Vítor Hugo (28 September 2015). "A herança portuguesa de Griezmann, Antoine 'Lopes' Griezmann" [The Portuguese heritage of Griezmann, Antoine 'Lopes' Griezmann]. Maisfutebol (in Pọtiugiz). Retrieved 5 July 2016.
- ↑ "Aux origines de Payet, Giroud et Griezmann". La revue française de Généalogie (in Frẹ́nch Lángwej). Retrieved 18 February 2018.
- ↑ Wallace, Sam (3 July 2014). "France v Germany World Cup 2014: Antoine Griezmann's rapid rise can outpace German rival". The Independent. Archived from the original on 7 May 2022.
- ↑ "Ist der Vater von Antoine Griezmann Deutscher?". watson.de.
- ↑ 9.0 9.1 9.2 "Griezmann: "Un rêve de porter le maillot bleu" (Griezmann: "It's a dream to wear the blue jersey")" (in Frẹ́nch Lángwej). French Football Federation. 25 June 2010. Archived from the original on 29 June 2010. Retrieved 27 June 2010.
- ↑ "Antoine lloraba al principio y estuvo tres veces a punto de irse" [Antoine wept at first and was about to leave three times]. El Diario Vasco (in Spánish Lángwej). 1 October 2009. Archived from the original on 4 March 2016. Retrieved 19 July 2017.