Anne Rasmussen

From Wikipedia

Anne Rasmussen (dem bon am for 1959) na Amerika tisha an pesin wey dey stodi how difren difren kolsho dey mek muzik an how di muzik dey du pipul wey de lisin to am. Plenti of di wok wey Rasmussen du na abaut Arab Muzik for US an how dem tek de woship for Islam rilijon. Na Rasmussen bi di oga kpatakpata for di "William and Mary Middle Eastern Music Ensemble" sins 1994. Dey pik Rasmussen nem as di William M. an Anne B. Bickers professor of Midi Easta Stodis in 2014.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Northwestern Yunivasiti Rasmussen dey kolet e B.A satifiket. E du e Masta program for Yunivasiti of Denver. Wen Rasmussen wan du e Ph.D e go rid how difren difren kolsho dey mek muzik an how di muzik dey du pipul wey dey lisin to am (Ethomusicology) from Yunivasiti of Kalifoniha, Los Angeles. E klass mate dat time bi: A.J Racy, Timothy Rice, Nazir Jairazbhoy, Gerald Behague, an Scot Marcus.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Rasmussen don rait meni pepa in meni Niuz pepa or magazine.E don rait abaut meni tins like: Ethnomusicology, Asian Muzik, The World of Muzik, Di Garland ensakopediha of Wold Muzik, an di Harvard Dishonari of Muzik. Rasmussen produs four CD wey e tek rekod how pipul dey enta US an di komuniti muzik wey pipul dey sing for US. E bi forma Fulbright Sinior Skola an e dey wok as di Fest Vais Presidor of di Sosaheti for Ethnomusicology. Rasmussen dey tish "ethnomusicology" for Di Kolej of William & Mary sins 1993. For di Kolej, e stil dey kontro how Midu East Muzik group dey du tins. Rasmussen folo di Indonesian Ku'ran spika Maria Ulfah waka araund United States for di 1999 pafomas wey dey du wit di sopot of Midu East Stodis Hasosiashon of North Amerika. Wen e go risach abaut muzik for Oman kontri, Di govamet of Oman an di Sultan Qaboos Kolshoral Senta du parti for Rasmussen bikos of e wok for dia.