Anna Hardwick Gayton

From Wikipedia

Anna Hardwick Gayton ( Dem bon am in 1899 an e kpai in 1977) na Amerika pesin wey dey stodis kolshor, tradishional tori, an e dey kip meni old old tins wey e dey si for younga pipul.E dey popula bikos of how e yek gada informashon abaut tradishonal tori of Kaliforniha Indian pipul.Gayton don bi di presidor of di Amerika Folklore Sosaheti bifor in 1950.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Santa Cruz for Kaliforniha dey tek bon Anna Hardwick Gayton.Gayton go Yunivasiti of Kaliforniha, Berkeley to get e BA digri in 1923 e MA digri in 1924. In 1928, e finish e Ph.D for ridin "Anthropology".Na Alfred L. Kroeber an Robert H. Lowie. Gayon tek klass in "Psychology" an na Edward C.Tolman tish di klass. Di fest wuman to kolet Ph.D in "Anthropology" from Berkeley. Di pepa wey e rait for Ph.D na "The Narcotic Plant Datura in Aboriginal American Culture" Wen e dey du e Ph.D pepa, Gayton tok to meni Yokut an Western Mono pipul. Gayton rait nine pepa on Yokut an Western Mono tradishonal tori. Wen e stil de Yunivasiti, Gayton bi di Assistans Editor to di jonal American Anthropologist.E stil bi Assistans Editor bitwin 1932 to 1934.Gayon stil bi di Assistans Editor for Yale University Publications in Anthropology. Gayton mari Leslie Spier in 1931.Leslie Spier tu na pesin wey dey rait abaut tradishonal tori.

How e tek sopot Tradishonal tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Durin 1930s, Gayton join Amerika Folklore Sosaheti (AFS) an e bi dia Riview Editor of di jonal Journal of American Folklore from 1935 go rish 1940. Gay on stil bi di Assosiate Editor of di jonal from 1940 go rish 1943.E stil bi di oga patapata for AFS's Komitee on Risach in Folklore from 1945 go rish 1948.E stil bi di Vais Presidor of di AFS in 1947.An in 1950, e bi di presidor of di sosaheti in 1950.

Akademik karia an koleshon of old old tins[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1948, Gayton join di Staff of di dipatmet of Dekorativ Art wey dey Yunivasiti of Kalifoniha, Berkeley.E koko of e wok na to stodi di "Peruvian textile wey dey di Yunivasiti koleshon.Na Lila M' O'Neale wey fest de di dipatmet bifor Gayton kom fest stat di wok.