Anglican diocese of Abuja

From Wikipedia

Anglican Diocese of Abuja[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di Abuja province na one of di 14 provinces of di Church of Nigeria. Im na one of di 10 provinces wey dem first create when de division wey dey now was adopted in 2002, bikos say di Church of Nigeria dey grow and e dey big. Im headquarters dey Abuja. Di diocese get 17 dioceses, 96 archdeaconries and 476 parishes. Di first archbishop wey dem first get for Diocese of Abuja na Peter Akinola, from 2002 to 2010. After him na Nicholas Okoh wey become bishop for the diocese from 25 March 2010 to 25 March 2020. Henry Ndukuba na de archbishop of the diocese now. Dem install am on 25 March 2020.

Di province get 13 dioceses:

• Abuja (26 November 1989; Im Bishop na Henry Ndukuba; De first bishop na Peter Akinola wey dem consecrate on 16 November 1989)

• Bida (30 November 1999; Im bishop na Jonah Kolo)

• Gboko (15 January 2009; Im bishop na Emmanuel Nyitsse)

• Gwagwalada (26 November 1999; Im bishop na Moses Tabwaye)

• Idah (14 March 2005; Im bishop na Joseph Musa)


  • Kafanchan (5 September 1990; Im bishop na Marcus Dogo; Im first bishop na W. W. Diya, wey dem consecrate on 29 April 1990, Kaduna)
  • Kubwa (19 March 2005; Im bishop na Duke Akamisoko wey dem appoint in 2009; Note: Na Simon Bala wey die in November 2008 before)
  • Kwoi (23 May 2008; Im bishop na Paul Samuel Zamani)
  • Lafia (29 November 1999; Im bishop na Miller Maza)
  • Makurdi (24 September 1990; Im Bishop na Nathan Inyom)
  • Otukpo (11 December 1996; Im bishop na David Bello; wey come from Makurdi diocese; Ityobee Ugede na de first bishop wey dem consecrate in 30 November 1996, Oke-Bola)
  • Zaki-Biam (20 September 2018; Im bishop na Jezreel Vandeh)
  • Zonkwa (19 March 2005; Im Bishop na Jacob Kwashi)

Missions wey dey for Africa and North America:

  • Church of Nigeria Mission (Congo; 2005; Im Bishop na Abiodun Olaoye)
  • Church of Nigeria Mission (Nomadic; 2006; Im Bishop na Simon Peters Mutum)
  • Church of Nigeria Mission (Convocation of Anglicans wey dey for North America 2005; Im bishop na Martyn Minns)