Andrew Jonathan Nok

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Andrew Jonathan Nok, NNOM (11 February 1962 – 21 November 2017) bi Nigeria profeso for Biochemistry and di poblik afia seketri for di Nigerian Academy of Science. For 2010 na he bi di pesin wey dem giv di awod wey dem dey call National Order of Merit Award (NNOM), and fo 2013 e win anoda awod wey dem dey call Alexander Humboldt Prize. E die for 21st November 2017 afta e sick smal.

Early life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dey bon Nok fo 11 February 1962 fo Kaduna State, Northern Nigeria. Im papa and mama com from Nok village fo Jaba Lokal Government Area of Kaduna State. He bi go skul fo LEA Primary School fo Kaduna before he com go Government Secondary School, Kafanchan, na fo dia e kolet di West African School Certificate for 1979, for di same year e enta Ahmadu Bello University and for their e kolet bachelor degree fo biochemistry for 1983, and e kolet master degree for 1988 and fo 1993 e kolet doctorate degree. E mari Amina Nok and togeda dem born three chidren: Anita, Amanda and Nathan Nok.

Political career[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 29 July 2015, di governor of Kaduna state, Mallam Nasir Ahmad el-Rufai choose Nok and 12 oda pipu as commissioner for Health and Human services.

Fellowship[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Fellow, Nigerian Academy of Science
  • Fellow, Alexander von Humboldt Foundation
  • Fellow, Japan Society for the Promotion of Science
  • Lady Davis Fellows
  • Fellow, Nigerian Society of Biochemistry and Molecular Biology (NSBMB)
  • Fellow, Nigerian Academy of Science (NAS)