André Onana

From Wikipedia
André Onana
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromKamerun Chenj-am
Country for sportKamerun Chenj-am
Nem for lokal langwejAndré Onana Chenj-am
Orijina nemAndré Onana Onana Chenj-am
Fest nemAndré Chenj-am
Famili nemOnana Chenj-am
Wen dem bon am2 April 1996 Chenj-am
Ples wey dem bon amCentre Chenj-am
Fest langwejFrench Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokFrench Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialitygoalkeeper Chenj-am
Wen e stat wok2015 Chenj-am
Member of sports teamManchester United F.C. Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am
Sport number24 Chenj-am
Participant in2019 Africa Cup of Nations Chenj-am

André Onana Onana (dey bon am 2 April 1996) na Kamerun go-kipa wey dey kip for Man U futbol tim. Man U na futbol tim wey dey play Premiha Ligi kompetishon for England. Onana don play for FC Barcelona smol pikin tim bifor e sahin for AFC Ajax. Onana win three Ligi taitu for Ajax as e kip for 214 times for dem. Wen e kontract finish with Ajax, e join Inter Milan in July 2022. For Inter Milan, Onana win di Coppa Italia an Supercoppa Italia taitu for di fest year wen e enta di klub. Onana helep Inter Milan rish di final of Shampion Ligi. Man U sahin Onana for £43.8 million in 2023.

For e kontri, Onana don kip for Kamerun for 34 times. Dat 34 times na from 2016 go rish 2022 for now.

How e tek kip for klub-dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • FC Bacelona

Na for Nkol Ngok in Kamerun dey bon Onana . E join Bacelona from Samuel Eto'o Akedemi wen e bi 14 year old in 2010. Bikos at dat time, e stil dey onda-18 an no bi pesin wey dey bon for Europe, Onana fest go kip for di youth tim of Cornellà. E kom go kip for di fest tim of Vista Alegre di folorin sisin.

  • AFC Ajax

In January 2015, Ajax tok sey Onana go join dem as dia kipa. E start to kip for Ajax for di Eerste Divisie on February 2015. Onana sahin niu kontract in 2017 an e niu kontract finish in 2021. Onana sahin anoda kontract wey finish in 2022. For November 2019, Onana tok sey e go like go kip for one Premiha Ligi tim.

UEFA ban Onana on February 2021 for 12 month. Di risin bi sey Onana yuz one medisin kol Furosemide. Onana tok sey na mistek e tek yuz di medisin an sey na e wife medisin. Ajax beg UEFA about di ban as Onana do mistek about di medisin. UEFA kom ridus am from 12 month to 9 month in June 2021.

Onana yuz seven an * Inter Milan Inter Milan sahin Onana on 1 July 2022 on a Awuf transfa an e sahin for 5 years. For January 2023, Onana don helep Inter Milan win Supercoppa Italiana. Inter Milan win AC Milan for dat game. Onana stil helep Inter Milan win Fiorentina in May 2023 to win Coppa Italia. E stil helep Inter Milan to rush di final of di 2023 Shampion Ligi Final.a half years kip for Ajax an na 214 times e kip for dem.

  • Inter Milan

Inter Milan sahin Onana on 1 July 2022 on a Awuf transfa an e sahin for 5 years. For January 2023, Onana don helep Inter Milan win Supercoppa Italiana. Inter Milan win AC Milan for dat game. Onana stil helep Inter Milan win Fiorentina in May 2023 to win Coppa Italia. E stil helep Inter Milan to rush di final of di 2023 Shampion Ligi Final.

  • Manchester United

Man U sahin Onana with £43.8 million from Inter Milan on 20 July 2023. Man U tok sey dey fit top di moni with £3.4 million leta. Na Erik ten Hag wey bi forma koch of Onana for Ajax dey koch Man U. Onana fest game for Man U na one friendly game bitwin Real Madrid on 26 July 2023. Real Madrid win di game 2-0.

How e tek kip for e kontri[chenj-am | chenj-am for orijin]

Onana don fest kip for di youth tim of Kamerun. Kamerun fest kol am for dia Sinior tim wen dey play one friendly game against France Onana fest kip for Kamerun in a friendly game against Gabon on September 2016. Kamerun win Gabon 2-1. Onana kip for Kamerun wen dey play dia last game to kari nomba 3 posishon in di 2022 Afrika Kup of Neshons in Burkina Faso.

Kamerun put Onana nem for di list for di 2022 FIFA Wold Kup in Qatar. Na Onana kip dia fest game against Switzerland. E no kip dia sekod game against Serbia. Kamerun futbol koch Rigobert Song komot am from di tim bikos e tok sey Onana no dey lisin to im again.

Onana tok sey e no go play for Kamerun again on 23 December 2022.

Wetin pipo tok about e kippin[chenj-am | chenj-am for orijin]

Onana na kipa wey sabi pass di futbol wel wel. E no get fear for bodi wen futbol dey e leg. For di histri of Wold Kup, no kipa leg touch ball for plenti time wen e no dey e box-18 like Onana. Na 26 times Onana leg touch ball outside e box-18. Onana dey kip as if e na difenda for game.

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Onana get one famili memba Fabrice Onana wey bi kipa tu. Onana tok sey e no easi as a blak goal-kipa as di one mek am wok veri hard pass e oyinbo kipa.

Klub[chenj-am | chenj-am for orijin]

Templet:UpdatedPoint go mistek: Invalid parameter in <ref> tag

Appearances and goals by club, season and competition
Klub Sisin Ligi Nashinal cupTemplet:Efn Ligi kup Europe Odas Total
Division Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals
Jong Ajax 2014–15 Eerste Divisie 13 0 13 0
2015–16 Eerste Divisie 24 0 24 0
2016–17 Eerste Divisie 2 0 2 0
Total 39 0 39 0
Ajax 2016–17 Eredivisie 32 0 0 0 14Templet:Efn 0 46 0
2017–18 Eredivisie 33 0 1 0 4Templet:Efn 0 38 0
2018–19 Eredivisie 33 0 4 0 18Templet:Efn 0 55 0
2019–20 Eredivisie 24 0 3 0 11Templet:Efn 0 1Templet:Efn 0 39 0
2020–21 Eredivisie 20 0 0 0 6Templet:Efn 0 26 0
2021–22 Eredivisie 6 0 2 0 2Templet:Efn 0 10 0
Total 148 0 10 0 55 0 1 0 214 0
Inter Milan 2022–23 Serie A 24 0 3 0 13Templet:Efn 0 1Templet:Efn 0 41 0
Manchester United 2023–24 Premiha Ligi 0 0 0 0 0 0 0 0 0 0
Career total 211 0 13 0 0 0 68 0 2 0 294 0