Ameyo Adadevoh

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Ameyo Stella Adadevoh (dem bon am for October 27, 1956 an e kpai for August 19, 2014) na Naijá doktor wey pipul no wel wel for wetin e du mek Ebola no kash meni pipul for Naijá. When Patrick Sawyer enta Naijá wit Ebola, Adadevoh bi di doktor wey trit an mek suo Sawyer no komot fom di klinik as Liberia Govament dey shaut sey mek dey rilis Sawyer for dem bikos e na dia pipul an sey Sawyer get one mitin wey e wan du. Doktor Adadevoh no gre bikos Ebola wey dey Sawyer bodi fit kash poblik pipul if e rilis mek e dey waka abaut.Adadevoh bi di fest doktor wey no let pesin wey Ebola kommot for Hospitu in Naijá an dis one mek Ebola no kash meni pipul in Naijá. For August 4 2014, Doktor Adadevoh sef kom kash Ebola an stat to tek tritment.Adadevoh dai in August 19, 2014.

Tori of e life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Ameyo Adadevoh for Legos, Naija for October 27, 1956. Na Legos e stey most of e life.E papa na Babatunde Kwaku Adadevoh wey gud for Science mata an e papa papa na Herbert Samuel Macaulay. Herbert Macaulay na one of di pipul wey fom Naija kontrie.E papa papa kom fom Adadevoh famili for Volta Region wey dey.Adadevoh papa Babatunde Kwaku Adadevoh na doktor an bifor bifor vas shaselor University of Lagos. Doktor Adadevoh stil famili wit Nnamdi Azikiwe. Nnamdi Azikiwe bi di fest Presido of Naija.Doktor Adadevoh bi grite-grite grand pikin of Sara Forbes Bonetta an grite-grite-grite grand pikin of Ajayi Crowther. Adadevoh wok for First Consultant Hospital wia di imej of im grate-grandfada dey.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adadevoh go Mainland Preparatory Primary School for Yaba, Legos for e noseri skul (1961-1962).E kom go yuz two years for Boston, Massachusetts bifor e kom bak to e famili in Legos. Adadevoh go Corona School, Yaba for Legos in Naija for e pamari skul (1964-1968) an go Queen's School; Ibadan for e sekondiri skull (1969-1974)

Dr. Adadevoh rid Surgery ( how to du opurashion) in University of Lagos College of Medicine an dey giv am di Satifiket Bachelor of Medicine/Bachelor of Surgery. E du e one-year komposerie housemanship for Lagos University Teaching Hospital for 1981.Dr Adadevoh spend e residensi for Lagos University Teaching Hospital an get e West African College of Physicians and Surgeons credential for 1983. Dr Adadevoh go London to finish e feloship for Endocrinology for Hammersmith Hospital.Dr Adadevoh yuz 21 years for First Consultants Medical Center for Lagos, Nigeria. E wok for dia na as di Lead Consultant Physician and Endocrinologist

E wok abaut swine flu[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Dr Adadevoh fest warn Nigerian Ministry of Health wen H1N1 stat to kash Naija pipul for 2012.

E wok abaut Ebola virus[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Dr Adadevoh chek di Liberia man Patrick Sawyer as di fest pesin wey get Ebola as Ebola fest enta Naija for e hospitu for First Consultant Hospital for Legos in Naija for July 2014. Adadevoh no gree mek Sawyer komot for di hospitu even dey Sawyer sey na onli malaria e get no bi Ebola. Sawyer wan go bizness mitin for Kalabar bifor e kom di hospitu.Dr Adadevoh bi di lid doktor wey trit Sawyer.Di disishion to risk e life as e no let Sawyer komot for hospitu save Naija pipul mek Ebola no kash meni of dem.Wen dis happun, di Naija doktor don vex sey dey no wan wok again an dis wan mek mata bad wel well dat time.Adadevoh stil giv informashion an odas tins like nose mask to odas Doktor for dat Ebola piriod.

How e tek kpai an wetin dem tek honor am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ameyo_Adadevoh_way_Abuja

Na Ebola Vairus kil Adadevoh on August 19, 2014 for Legos in Naija.Govament pipul kom burn e bodi an e famili kolet e ashes an du pravate berial serimoni on September 12, 2014. To honor am, dey fom Dr. Ameyo Adadevoh Health Trust (DRASA), wey bi one health Organasashion wey no bi sey na bikos of moni dey tek fom am.Di fim 93 Days tok di tori of how Dr Adadevoh an odas medikal pipul at First Consultant Medical Center tek trit Sawyer an du so dat Sawyer no go waka komot for di Hospitu. Na Steve Gukas daret di fim. For October 27, 2018, dem honour am wit Google Doodle for di day wey e bi selibrate 62 biday. For February 2020, Naija Govament nem one road for Abuja wey bi Naija kapita siti afta Adadevoh. Di road "Ameyo Adadevo Way" join to Ahmadu Bello Way, one of Abuja's menjo an longest road. Dis na one of the fest tins wey Naija Govament tek honor Dr Adadevoh for wetin e du for di kontrie bifor e kpai.

Honor-dem and awod-dem wey e get[chenj-am | chenj-am for orijin]

Awods Year Given By
Posthumous Rotary Award 3rd Oct. 2014 Rotary Club of Abuja-Metro
National and Community Service Award 5 October 2014 Trinity House Church
Honorary Doctorate Degree: Doctor of Letters, Honouris Causa 11 October 2014 [Baze University]
Nollywood Humanity Award 18 October 2014 Nollywood Movies Awards
Arise Award 25 October 2014 [Redeemed Christian Church of God]
Posthumous Award 3 November 2014 Women in Management, Business Organizations and Public Service (WIMBIZ)
Exemplary Leadership Award 12 November 2014 Pathcare Laboratories
Distinguished Service Award 15 November 2014 Guild of Medical Directors FCT Abuja
Commemorative Plaque 19 November 2014 Nigerian American Medical Foundation
Nigeria’s Hero of the Year Award 30 November 2014 The Sun Awards
2014 SEC Integrity Award 1 December 2014 Security and Exchange Commission
Number 1 Humanitarian Everyone Should Know About (2014) 11 December 2014 International Medical Corps UK
Woman Who Shaped 2014 22 December 2014 The Guardian
Number 1 Global Thinker of 2014 23 December 2014 Lo Spazio della Politica
Leading Woman of 2014 23 December 2014 CNN
Person of The Year 2014 31 December 2014 Ekekeee
Nigerian of the Year Award 4 January 2015 National Infinity Magazine
Honorary Doctorate Degree: Doctor of Science, Honouris Causa 17 January 2015 [National Open University of Nigeria]
First Woman 11 March 2015 [First Bank of Nigeria]