Alsarah

From Wikipedia

Alsarah ( dey bon am in 1982) na Amerika wuman wey e gra-peret kom from Sudan. Alsarah na singa, song-raita, an pesin wey dey stodi how difren difren kolsho dey mek muzik. E bi di lida of di grup Alsarah & the Nubatones. Alsarah grup don pafom wit meni oda grup like The Nile Project. Di nik-nem wey e dey ansa bi wen dey join "al" wit e ril nem "Sarah" to give "Alsarah".

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Khartoum in Sudan dey bon Alsarah. Alsarah peret na pat of di pipul wey dey fight mek govamet no trit pipul enihow. Wen Alsarah dey eight year, e peret komot from Sudan bikos of di way Omar al-Bashir tek yuz by force kolet pawa to bi presidor of Sudan in 1989. If Alsarah peret no komot for Sudan, dey fit kil dem bikos di niu presidor fit tink sey dey bi pipul wey no go wan lisin to e kontro. Alsarah famili komot from Sudan go dey stey in Taez in Yemen. Wen fight an war stat for Yemen in 1994, Alsarah famili pak komot United States an dey live for Boston as pipul wey komot from dia kontri bikos of fight fight. Wen all dis tins dey hapun in Alsarah life, e dey find hapiness in lisin to redio, lisin to muzik wey kom from Yemen an tekin piano lesin from famili frend. Wen e dey United State, Alsarah sing for meni Wold muzik hevet an e go stodi for Pioneer Valley Pafomin Akts Charter Poblik Skul. Alsarah rid Ethnomusicology at Wesleyan Yunivasiti. Na for di Yunivasiti e tek rait sinior Pepa on Sudan [Zār]] muzik.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen Alsarah finish Yunivasiti in 2004, e go New York Siti an stat to sing as profeshonal singa in Arabik langwej an e dey du difren job join di singin to fit chop. Alsarah bi di singa for di Zanzibari band Sound of Tarab.

Alsarah & the Nubatones[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na in 2010 Alsarah fom Alsarah and the Nubatones. Pipul wey de inside di band na: e sista Nahid, bak-up singa Mawuena Kodjovi, ginta playa Luthier Haig Manoukian ( wen e kpai, Brandon Terzic kom join dem dey du Luthier Haig Manoukian wok), drum bita Rami El-Aasser of di Cafe Antarsia Ensemble