Allison Balfour

From Wikipedia

Allison Balfour or Margret Balfour na one of di wuman wey dey joj e kase sey e na witch in 1594 for Scotland. Na for Orkney Hiland of Scotland wey dey aria of Stenness Balfour dey stey. For dat time for Scotland, di Scottish Witchcraft Art 1563 tok sey eni bodi wey dey katch as Witch go kpai. Na Patrick Stewart, 2nd Earl of Orkney wey pipul sabi as Black Patie dey kontro Orkney wen dey joj Balfour in 1594. Patie biliv sey e yonga broda espeshial John Stewart, Earl of Carrick, dey plan to kil am. Patie kom diskova Poisin medisine in one of di savant wey dey wok for John. Di savant nem na Thomas Paplay. Afta wey dey don bit di savant for eleven days, e tok sey Balfour de among di pipul wey wan kil Patrick Steward, 2nd Earl of Orkney. Bifor dey finali kil di savant, e tok sey Balfour no dey among dose wey wan kil Patrick Steward. Even sey di savant tok sey Balfour hand no dey for di plan, dey stil kari Balfour familia go Kirkwall. For dia, dey flog am onti e gri sey e hand de dia. Di kot tok sey Balfour na no somtin abaut di posin medisine, sey e na Witch an sey mek dey go kil am. Just like di savant Paplay, Balfour tok sey e no no enitin abaut all di tin wey dey tek hakuss am but dey stil kil am on December 16, 1594. Bifor e kpai e tok of all di sofa sofa wey den du e famili an sey e hand klin for di mata. Na for Gallow Ha' Kirkwall dey tek kil am.

Tori of Witch for Orkney[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di Hiland of Orkney get dis old biliv sey Witch, juju an sey odas extra ordinari living tins de. Meni pipul for dia biliv sey majik pawa na norma pat of life an sey notin bad abaut am. By 1550, di pipul of Scotland stat to katch Witch. Di pipul wey dey mek law onda Mary Kween Of Scot pass di Scottish Witchcraft Act in 1563. Di law tok sey eni Witch wey dey katch na kil dey go kil am. Even sey di Orkney Hiland dey Honda Norway law onto 1611, na Scotland dey kontro di Hiland from 1468 onda di rule of Scottish lord. Na Patrick Stewart, 2nd Earl of Orkney day kontro di Hiland in 1594 wen dey fest stat di findin of Witch in Orkney.