Allen Ifechukwu Onyema

From Wikipedia

Ifechukwu Onyema CON (dem bon am in 1964) na Naija lorya an biznes pesin. Na im bi di oga kptakpata of Air Peace, wey e stat in 2013.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am in 1964 insaid Benin city, Nigeria. Im papa an mama na Micheal an Helen Onyema an na im bi di fest bon insaid nine pikin. E kom fom Mbosi Ihiala Lokal Govmet Aria Anambra State Nigeria.

Edukashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Allen stodi lor for University of Nigeria an finish in 1987. E go Nigeria Lor Skul an dem kol am to Bar in 1989. E go difren Skuls lik Government College, Ughelli, Delta State. E komot for Government College in 1984 afta e don get Higher School Certificate wey mek dem giv am admission to stodi lor for Nigeria Premier University, di university of Ibadan day sem year. Na wen e dey university bikos of e no lik mek pipu dey faight mek am kari nine oda student folo bodi travu go Zaria to setu wahala wey dey hapun bikos of traib an religion. Plenti pipu sabi dem afta dem finish di faight, wen Onyema an im friend rish dia campus dey stat one grup wey dey kol Eminient Friends' Group - grup wey dem du to dey setu wahala wey dey hapun bikos pesin dey for difren traib. Wen e finish for Universiti in 1987, e stat dey get branch for evri stet insaid Naija. Wen e dey lor skul e dey join stodi wit some oda tins lik hau e tek dey mek pipu liv in peace. Wen e finish for Universiti in 1987, e stat dey get branch for evri stet insaid Naija. Wen e dey lor skul e dey join stodi wit some oda tins lik hau e tek dey mek pipu liv in peace.

Katakata wey e get wit US[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 2019, di US Depatmet of Jostis opun kase wit Allen Onyema, bikos dem tok sey e du wuruwuru for bank. Dem tok sey e lie wit di kain dokumet e use dey buy aeroplane an big motor for Air Peace. Onyema no gree wit wetin dem akuse am for. In October 2022, pesin wey dem akuse wit Onyema dey 3 years wit polis pipu.