Akinsola Olusegun Faluyi

From Wikipedia

Akinsola Olusegun Faluyi (dem bon na for November 13, 1934) na Naijá Mekanika enjinia an forma Presidor of "COREN" wey bi di join bodi of enjinias an enjiniarin regulatshion bodi for Naijá.

Tori abaut e life an karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Akinsola Olusegun Faluyi for November 13, 1934.E midu nem na "Olusegun" wey if we chenj am to inglish e go min "Na Baba God win". Faluyi go Ibadan Boys High School, for Oyo Stet, Naijá wie e kolet e West Africa School Certificate (WASC) an e leta go Loughborough University wie e kolet im fest digree (B.Eng) in Mekanika enninearin (1953-1985). Faluyi join di sarvis of di University College Hospital, University of Ibadan as Hospital Enjinia in 1960.E komot for di tishin hospital afta two years of sarvis as hospital enjinia to join di Lagos University Teaching Hospital (LUTH) in 1962 as Shif Enjinia. In 1975, Faluyi ritaya fom LUTH for 1975 go join Edison Group and Partners. E bikom di Presidor of di Nigerian Society of Engineers (NSE) fom 1985 go rish 1986.Faluyi leta bikom di presidor of COREN.E kon still sav as Presidor of di Nigerian Academy of Engineering.

Fellowship[chenj-am | chenj-am for orijin]