Jump to content

Akin Ogungbe

From Wikipedia

Christopher Akintola Ogungbe (1934 – November 2012) na Naija fim actor, filmmaker, producer and director wen i dey alive.

How i stat life and karia

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am 1934 for Abeokuta, di kapita of Ogun State, Southwestern Naija. I die for November 2012. Afta im stop skool im mama carry am give im grandmama. Im fest go learn tailor im stat to dey learn sins i don dey put eye for Baba GT Onimole. According to watin Im brother tok i fest pla na "a terrible life" and im stage nem na Baba Ibeji. Im don feature, direkt and produce meni Naija fim like Ireke Onibudo and 50-50 wey dem produces in 1990 wey feature ogbonge funny aktor Bolaji Amusan.

Im get 20 wives and 50 children, among im pikin na Naija fim aktor, direktor and produsa, Segun Ogungbe.

Fim wey im dey

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • 50-50 (1990)
  • Ireke Onibudo
  • Asiri Baba Ibeji
  • Ologbo Jigolo
  • Lisabi
  • Igba funfun