Aisha Abimbola

From Wikipedia

Aisha Abimbola (Dem bon am for December 19, 1970 an e dai for May 15, 2018) na Naijá Aktress wey dey popula for yoruba fim wel wel. Na for Epe insaid Legos Stet dey tek bon Abimbola.

How e tek stat laif an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dey born Abimbola for Muslim familibl bot e chenj to kristen wey e gro up an na kristen e bi til e dai.For one niuzpepa wey bi New Telegram Neepaper, Abimbola tok sey na pastor e for bi if no bi sey e dey akt fim. Abimbola na waif to Victor Ibrahim Musa and e bon two pikin for e hosband. Abimbola go Ebute Elefun High School an na e bi di Senior gel for the klass wey pass out for 1994.Afta e finish sekondri skul,e go Lagos State Polytechnic (LASPOTECH) an e kolet HND Satifiket for pipul wey fit mek fud for plenti pipul an manej hotel wey Oyinbo dey kol Catering and Hotel Management.E go saf Naijiria as youth koppa in 2002.

How e tek stat to akt fim[chenj-am | chenj-am for orijin]

Abimbola stat to akt fim wen Wale Adenuga Production kom LASPOTECH, ( di skul wey Abimbola dey go) du one fim.Abimbola tok to di dareto of di fim Antar Laniyan sey e wan akt for di fim wey dem dey mek.Abimbola dey lorki sey one pesin wey soposs du one pat for di fim no kwik kom an dey sey mek e du am.E jost bi laik sey na Baba God buta e bread an Abimbola du di pat wit all e pawa na so door opun for am to dey akt fim.Di fim wey mek am popula na Omoge Campus wey Bola Igida du in 2001. Afta dat fim, Abimbola kom bi pesin wey pipul laik for yoruba an Inglish fim bikos e no how to akt. Abimbola leta bikom pesin wey dey mek fim tu and im fest fim na T'omo T'ẹjẹ in 2016.Na for outsaid kontris for Atlanta wey dey Amerika na e dey tek fest sho di fim an na king Rokan pafom as singa dat taim.

Fim wey e du[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • No Pain
  • No Gain
  • Awerijaye
  • So Wrong So Right
  • Omoge Campus
  • Kamsom and Neighbours

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • City People Entertainment gif Abimbola di Awod wey di nem na Yoruba Movie Personality of the year in 2015

How e tek dai[chenj-am | chenj-am for orijin]

Abimbola dai for one hospitu wey dey Canada and na breast Kansa kil am.Pipul wey dey akt rili feel pain wen dey no sey e don dai.Abimbola na 46 years old wen e dai.Di two pikin wey e bon born de wit im best friend Lola Alao as kot tok sey mek Lola Alao dey tek kia of di pikin wey Abimbola hosband tek di mata go kot.