Agbor

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Agbor
human settlement
KontriNaija Chenj-am
Located in the administrative territorial entityDelta State Chenj-am
Coordinate location6°15′10″N 6°11′59″E Chenj-am
Local dialing code055 Chenj-am
Map

Agbor na im dem tek as di lajest city among di Ika nashons. Agbor lokashon dey for Ika south-south geo politkal zone of Naija, West Africa. Pipul know di Cory for im rish history especially for di area of folklore and oral tradishon. Agbor na di headquarters of Ika south lokal Govnment Area in Delta stet Nigeria. Agbor bikom univasiti town for 2021 as di old kolej of Edukashon get handsome upgrade into digri awod skul.

Strong pipul for Ika[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Jim Ovia -Nigerian business man
  • Sunday Oliseh - Nigerian football manager
  • Ifeanyi Okowa - Nigerian politician
  • Godwin Emefiele Governor of central bank of Nigeria.

Tori about di ples[chenj-am | chenj-am for orijin]

Agbor get rish history wey dey link to Ancient Benin Empire. meni pipul biliv sey na one Oba Ewedo of great benin Empire son na im find Agbor. Prince Ogugunagbon one of di twin sons of Oba Ewedo komot for Benin Empire mek e go form im own kindom wey we no today as Agbor. No wonda Agbor pipul dey share di sem kolshor wit Binin pipul.

Town wey dey di ples[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ogbemudein, Ogbease, lhogbe, Obiolihe, Lhiakpen, Ogbeisogban, At a muse/Oruru, Alifekede, Omumu,,Alisor, Alilehe, Oza-nogogo, Agbobi Alisimie, Ewuru, ldumu-oza, Aliokpu, Aliagwai, Agbor-nta, Alihame Alihagwu, Oki,Ekaku-Agbor, Emuhun,Boji-Boji Agbor. Di Aladja-ltakpa Ajaokuta rail crosse tru di city of Agbor go reach di terminal wey dey for owa wey go reach two steel hubs for Nigeria (Alidja and Ajaokuta)

Different-different school wey dey dia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Agbor na house wey get plenty Education institutions. Some of dem include University of Delta State Agbor.(wey be say before na college of education Agbor) States schools of nursing and Midwifery Agbor, Agbor Technical college Agbor and di proposed Anioma open University Agbor.