Agbassa

From Wikipedia

Agbassa na di nem of one of di two Urhobo kingdoms for Warri South Local Government, Delta State, Nigeria. Di oda one na Okere-Urhobo. Oyinbo people wey bi British na dem form di name 'Agbassa' from him original nem wey be 'AGBARHA', wey dem still dey use till today. Di king wey dey on top throne for Agbassa kingdom presently be H.R.M Orhifi Ememoh II, (ovie Of Agbarha Kingdom Warri).

Communities Inside Di Kingdom[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na seven communities join together come make up Agbarha Kingdom (Agbassa):

  1. Otovwodo ( Wey be traditional Headquarters)
  2. Igbudu
  3. Edjeba
  4. Ogunu
  5. Okurode (Okurode Urhobo)
  6. Oteghele
  7. Ukpokiti

For Agbassa, dem dey celebrate Iyerin,Esemor plus Iniemor festival every year. Another festival wey dem dey call Idju, na him dem dey celebrate every two years for inside all the communities wey dey for Agbassa plus including Okere-Urhobo. This festival na him dem dey call Idju Owhurie Festival wey everybody sabi as Agbassa Juju wey get to do with the worship of Owurhie a god for Urhobo land.