Adrienne Roy-Vilandré

From Wikipedia
Adrienne Roy-Vilandré
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromCanada Chenj-am
Fest nemAdrienne Chenj-am
Famili nemRoy, Vilandré Chenj-am
Noble titlemarquess Chenj-am
AliasYohadio Chenj-am
Wen dem bon am3 February 1893 Chenj-am
Ples wey dem bon amLévis Chenj-am
Wen e kpai23 October 1978 Chenj-am
Place of deathMontreal Chenj-am
Wok wey e dey duvocalist, folklorist Chenj-am
Voice typesoprano Chenj-am

Adrienne Roy-Vilandré ( dem bon February 13, 1893 an e kpai October 23, 1978) na Quebec singa an wuman wey dey rait abaut tradishonal tori.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for February 13, 1893 dem bon Adrienne Roy-Vilandré for Levis, Quebec. E papa nem na A.R.Roy an e mama nem na Dubiana Deslauriers. Adrienne papa dem among bi pipul wey get one lokal Lévis Niuz-Pepa kol "Le Quotidien de Lévis". Wen Adrienne sef gro up e rait abaut e expirihens as e dey travul araund. Adrienne go skul wey Ursulines chorch sista dey kontro in Quebec Siti. Adrienne leta travul wit e peret go Europe. Na for Quebec e tek len how to sing wit Jeynevald-Mercier, e hosband François-Xavier Mercier, wit Victor Occellier an Berthe Roy. Afta dat, Adrienne Kon stat to dey sing on e own at di klub musikal de Quebec in 1913. By 1922, Adrienne don get pat for André Messager singin an aktin play kol Véroniqu. In 1922, Adrienne travul go Paris an na dia e tek stodi wit Jane Berthori for two years.Wen e stil dey stodi, e go luk one song hevet wey Yvette Gilbert du an na from dat hevet e luv for tradishonal tori tek gro. Wen e kom go bak to Quebec, Adrienne dey one of di fest wey sing di wok wey Honegger, Milhaud, an Poulenc in Quebec. Adrienne give hundreds of paformans akross Canada as pat of di Alliance francaise, l'Association France-Canada, an di Canadian Institute of Muzik. Bikos of e wok, pipul stat to like e wok an in Expo 67 American Pavilion yuz some of e wok. Adrieene stil pafoms for redio stashon like CKAC (Montreal) an CBOFT (Ottawa) in Canada. E stil pafoms for New York for French-Canadian komuniti an di studio of di French komposa Charles Lagourgue. Adrienne stil poblish an rait hatikul abaut muzik but e yuz difren nem wey no bi e ril nem tek rait am. Di nem wey e yuz na "Francine" . Adrienne yuz di nem tek rait for Quebec poblikashon like Le Mirror, L:Autorité an Le Jour Adrienne dey mek suo sey e paformans na two pat, one pat e go fest sing French Canadian tradishonal song an di sekod pat e go selet some Indian song wey Canada pipul wan lisin to.