Adamu Suleiman

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Adamu Suleiman
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Wen dem bon am14 May 1929 Chenj-am
Ples wey dem bon amKano state Chenj-am
Wen e kpai23 May 2005 Chenj-am
Wok wey e dey dupolice officer Chenj-am

Adamu Suleiman (dem bon am for May 14, 1929) na Naijá polisman an e get one time wey Adamu Suleiman bi di oga kpata-kpata for polis for Naijá. Dem mek am di oga kpata-kpata for polis for 1979 afta Muhammadu Dikko Yusufu don du e own an afta Adamu du e own oga for polis finish, na Sunday Adewusi kom kontinu for 1981.

Na for inside 1940 an 1944 im stat im skul for ’'Jimeta Elementary School, afta dis one e kom go Yola Middle School go rish 1947. E stil go Barewa kolej for Zaria fom 1947 go rish 1950 an for inside 1954 go rish 1956 e go kolej of teknoloji. E stil go yunivasiti of Ibadan an na dia dem giv am one satifiket for Modern History for 1960.

For May 1 1966, dem put Adamu inside polis an na big oga im bi for dia.

Dey kom mek am di oga kpata-kpata for polis for October 1979 an e du dis one wen Shehu Shagari bi di presidor for sekond Ripoblik til e kom ritaya fom polis wok for April 1981.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]