Abdu Gusau Polytechnic

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Abdu Gusau Polytechnic na one Stet Govament politeknik wey dey for Talata Mafara, Zamfara Stet inside Naija.

Tori abaut di skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di politeknik don dey sins 1992 afta di gofnor wey dey bifor for Sokoto Stet, Yahaya Abdulkarim sign di bill wey dem tek mek di "Talata Mafara Polythecnic". Di Sokoto Stet Govament chenj di nem of di Politeknik to "Abdu Gusau Polytechnic" in February, 1995. E du am to honor di late Enjinia Abdu Gusau wey dai in November, 1994 for all di tin wey e don du to divelop di Stet.Wen dey fom Zamfara Stet in 1996, dis one mek dem kari di Politeknik go a niu pamanet site in Talata Mafara. Di Sokoto Stet Govament no gree mek dey yuz dia moni to dey tekia of skul wey Zamfara get, an na dis risin mek dem kari Audi Gusau Politeknik fom Sokoto Stet to Zamfara Stet.