Gani Odutokun

From Wikipedia
(E kom from Gani ofutokun)
Jump to navigation Jump to search

Gani Odutokun (Dem bon am August 9, 1946 an e dai February 16, 1995) na Naijá man wey no how to paint wel wel an e dey popula for tins wey e don du to hep an tich pipul wey dey draw for Zaria art Society. Pat of im wok na wall murals, painting an buk kova dezain.

How e tek stat e life an go iskuls[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem born Odutokun for Nsawan, Ghana bot na Naijá pipul bi im papa an mama. E paret bi Yoruba pipul wey bí sey na fom Offa, Kwara stet dey tek kom an na kooko bizness dem dey du. Na for Ashanti im tek du im smol pikin bot im papa leta kom bak Naijá wen kooko no tu dey go wel like bifor. Afta him finish him sekodiri skul Odutokun wok as mesenja for Naijá brewery. Wen e frend see am sey e gud for art, dey advais am to go skul more an Odutokun chuz Ahmadu Bello University for Zaria an dem pik am. Odutokun finish for di skul wit Bachelor an Masters digree in fine art in 1975 an 1979. E Kon go join fine art dept for A.B.U as a graduate assistant.

Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Odutokun wok popula wel wel bikos e wok dey sho fine fine tins of life. Som of e wok somtaim dey taku wetin Oyinbo pipul-dem wan see for Afrika art. Odutoku dey also yuz e wok tekb tok abaut Politiks tu.

How e tek dai[chenj-am | chenj-am for orijin]

Odutokun dai inside moto assident wen e dey kom bak fom Goethe Institute;for Lagos.E dey amog di 4 pipul wey dai for di moto assident