Wikipedia

From Wikipedia

Wikipedia na free buk for evritin wey pesin wan sabi an e dey for intanet. E dey for langwej wey pas 300. Pipul fit yuz am, shia am an chenj am and dem no nid to pay moni. Na im bi di Wiki wey big pas. Pipul fit dash Wikimedia Foundation moni to sopot Wikipedia an oda projet-dem wey bi like am. Na websait wey dey opun. E mean sey enibodi fit kopi am and chenj am if dem folo di rul wey dey am.

Na one Amerika grup wey di nem na Wikimedia Foundation get am an e dey San Francisco, California.

Dem get Wikipedia from two nem wey dem join togeda, wiki and encyclopedia.

Na for January 10, 2001 dem stat Wikipedia. Na Jimmy Wales an Larry Sanger stat am wen e bi Nupedia. For January 15, 2001, Wikipedia bikom websait wey stand on im owm.