Bimbo Oshin

From Wikipedia

Bimbo Oshin(dem bon am 24 July 1971)shi bi Naija aktress.

Tori About Ha Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bimbo Oshin dem bon ha on 24 julai 1971fo Ondo, wan citi for ondo state southwestern Nigeria. Oshin go University of Lagos wia shi kolet ha Bachelor of Akts(B.A)digri for philosophy. Bimbo continue ha aktin karia fo 1996 bot shi kom dé popula fo 2012 wen shi akt fo wan Yoruba fim wia do taitu na omo Etemosho.

Wen Shi Bi Smol Pikin[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bimbo Oshin gro op fo ondo state wia shi do ha primari edukeshon saint Anne's primari skul. Lara shi kom go Girls Academy,sand grouse fo Lego's stet. Bimbo Oshin skul fo University of Lagos wia shi graduate wit Bachelor's of Akts ( B.A)degree fo Philosophi.

Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bimbo Oshin luv fo aktin don de since shi bi smol pikin. Shi don dey do smol drama for hause wit ha senior sista or broda dem DAT taim dem de record do drama wia dem de akt. Not ha karia for aktin stat wen shi stil be ondagraduate fo University of Lagos. Ha sista frend dem tel ha about one group wia dem de cal Ara Osan group. Ha elda sista tok sey as a don join di group u self go join, Bimbo agri kom join did group (Ara Osan)fo1996 kom stat to go fo rihasia dem.Ara Osan thiata group, did group na Rassaq Ajao get di group an shi spend 5 years onda ha oga. Bot shi stat ha muvi Maria wit inglish soap opera an nau shi de fuli fo Yoruba muvi industri an dey do well.Do fest muvi wia mek pipu sabi ha we'll na di fim "Akobi" wia dem rilisi fo 1997.

Hau Much Shi worth[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bimbo Oshin na big wuman ha moni de around $18 million bot I de onda check.

Som Fims Wia Shi Don Akt[chenj-am | chenj-am for orijin]

Omo Elemosho (2012) Kakanfo (2020) The New Patriot (2020)

Awods An Ricognishon Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2016 dem honour ha wit Icon category Awod for di 2016 Afro-Heritage Broadcastin an Entatianment an Awods.

Caption text
Year Awods Cerimoni Prizi Result Ref
2014 Yoruba Muvi Akademi Awods Best Aktres fo lidin rol Nominate [9]
2014 Citi pipu Entatainment Awods Best Aktres of di yea(Yoruba) Nominate [10]
2015 ZAFAA Afrika fim Akademi Awods Best Finale indigenous Akto Nominate [11]