Jump to content

Zora Neale Hurston

From Wikipedia

Zola Neale Hurston ( dey bon am January 7, 1891 an e kpai on January 28, 1960) na Amerika raita, pesin wey dey stodi how pipul dey live in di past an e na fim-meka. Hurston rait an tok abaut how oyinbo pipul an blak pipul dey trit demsef for American South in eli 1900s. E stil rait abaut di spirit pratis-dem wey blak pipul dey paform in di past wey bi Hoodoo. Inside di four buks wey Hurston rait, na Their Eyes were Watching God pipul no pass. Dey poblish dat buk in 1937. Hurston don rait ova 50 smol smol tori an play.

How e tek stat life an go soul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Notasulga, Alabama dey bon Hurston on January 7, 1891.Wen Hurston bi three year old, e move wit e famili go Eatonville, Florida in 1894. Eatonville bi di onli town wey bi sey na blak pipul full am an wey United State biliv sey di town na among United State town.Hurston bi di nomba five out of di Eight pikin wey John Hurston an Lucy Ann Hurston bon ( e mama nem na Potts bifor e mari). Na for inside slave dey bon all di four grandperet wey Hurston get. John Hurston wey bi Hurston papa Baptist prisha an pesin wey dey boro land to farm. Hurston papa leta bikom kapitaa. Lucy Ann Hurston wey bi Hurston mama na skul tisha. In 1897, Hurston papa bikom chairman for di town. In 1902, Hurston papa bikom pastor in Macedonia Missionary Baptist. Na dat church big pass for all di chorch wey Baptish get dat time. Wen Hurston gro up, e dey always yuz Eatonville wen e wan rait e tori. Na onli Eatonvile town Hi di onli ples wey blak pipul fit live an du enitin wey dey like Oyinbo pipul no go tok or du dem enitin. Wen some Norta tisha kom Eatonville in 1901, dey pak some buk give Hurston an dis one opun e eyes to ridin buks. Na for Eatonville Hurston du e smol an e too abaut life for di town in di buk "How it feels to be Colored Me". Evri year, di Eatonville town dey du one big parti to rimemba Hurston. Di nem of di parti na "Zora! Festival".