Zofia Kowalewska
Zofia Kowalewska ( dey bon am in 1853 for Bakszty Male an e kpai in 1918 for Minsk) na wuman wey kom from Poland wey dey rait histri, e dey stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way. Zofia na wuman wey stil dey fight for pipul so dat dia life go beta.
How e tek stat life an wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na for 1853 dey bon Zofia Kowalewska in "Bakszty Male". Bakszty Male dey pat of di aria wey Russia empaya dey kontro bifor bifor. Zofia famili get plenti land wey dem de kontro for Poland. Zofia nem bifor e mari na Zofia Lẹtowski. Na Eugeniusz Zawadzki wey kom from Vilnius County Zofia mari. Wen e dey e house, e dey tish edukeshon tins an also dey sikrit tish Poland langwej an histri of Poland. E rili wok wel wel mek Poland kolsho no kpai among di lokal pipul of Poland. For di buk-dem wey Zofia Kowalewska dey rait, e dey tok abaut di plan an hope wey all Poland pipul get dorin di January riot in Poland an how Poland pipul dey live an du tins in Minsk. Zofia Kowalewska rait tori abaut tins wey hoganazashon wey dey fight govamet dey du in Poland. E stil rait abaut how dos hoganazashon tek stat in 1863. Na Józef Zawadzki buk-shop wey de Vilnius poblish meni of di buks-dem wey Zofia Kowalewska rait. Zofia like to dey rait abaut di lokal tradishonal tori an e stil like to dey rait abaut pipul kolsho, how pipul dey du tins in dia lokal ways. Zofia sopot di "Polish Sosaheti for Edukeshon an Shariti" wey de Minsk. Zofia stil rait hatiku an smol smol tori in "Kurier Litewski" an "Eisla" Na February 22, 1918 Zofia kpai in Minsk di kapital of Belarus. Na February 22, 1918 Sofia kpai in Minsk. Minsk na di kapital of Belarus.
Buk-dem wey e don rait
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Obrazki Mińskie 1850-1863, nakładem księgarnia Józefa Zawadzkiego w Wilnie, 1912
- Ze wspomnień wygnańca z roku 1863, nakładem księgarnia Józefa Zawadzkiego w Wilnie, 1912
- Z pamiętników doktora:powieść współczesna, nakładem księgarnia Józefa Zawadzkiego w Wilnie 1913
- Dzieje powstania lidzkiego: wspomnienie o Ludwiku Narbucie, nakładem Wyd. "Dziennika Wileńskiego" w Wilnie, 1934