Jump to content

Zainab Lawal Gummi

From Wikipedia

Zainab Lawal Gummi nah de Commissioner for Education for Zamfara State for Naija.][1] Governor Bello Matawalle nah im appoint am put for dat position.[2][3]

Gummi don tok say she dey support free education for everybody and equal rights for men and women.[4] She still tok say Zamfara State government dey committed to end all kain of child abuse, like pikin suffering for street, child trafficking, and child labour. Dem go do am through traditional rulers and by working with Islamic scholars wey go help guide how dem go carry out de laws.[5]

Fight against gender-based violence and support for education

[chenj-am | chenj-am for orijin]

As Commissioner for Women Affairs and Social Development for Zamfara State, Zainab Gummi don do plenty work to fight against gender-based violence. She con encourage people say make dem treat women wey don suffer gender-based violence well and make dem protect dem. She also call communities and other big stakeholders make dem support efforts wey dey protect the rights and welfare of women across Zamfara State.[6][7]

How she dey encourage women make dem join politics

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For November 2022, Gummi show say she happy with di court judgement wey concern Aisha Binani. She tok say de court ruling show people for dis kontri say courts for Nigeria dey ready to make sure say justice prevail anytime e necessary. She still tok say de ruling show say women don become more active and get more influence for Nigerian politics. According to am, dis development be sign say more people for Nigeria don dey accept women for politics.[8]

  1. "COVID-19: Zamfara government receives 45 "Almajari" deported from Kaduna State". The Guardian. Lagos, Nigeria. 2020-05-18. Retrieved 2020-11-18.
  2. "Zamfara commissioners, advisers get portfolios | Premium Times Nigeria". 2019-12-11. Retrieved 2020-11-18.
  3. "Nigeria: Zamfara Governor Places Commissioners, Advisers On Three-Month Probation". allAfrica.com. 2019-12-06. Retrieved 2020-11-18.
  4. III, Editorial (2020-03-18). "Zamfara commissioner advocates gender equality, free education for women". Blueprint. Abuja, Nigeria. Retrieved 2020-11-18.
  5. "Zamfara engages traditional, religious leaders to end child abuse, trafficking".
  6. "Gender Based Voilence: Zamfara Women Affairs Commissioner Wants Fair Treatment for women - The Invisible Insider". 2022-12-11. Archived from the original on 2026-01-17. Retrieved 2026-05-22.
  7. "Zamfara commissioner advocates gender equality, free education for women - Blueprint Newspapers Limited". 2020-03-18. Retrieved 2026-05-22.
  8. Nwannah, Ifeanyi (2022-11-25). "Adamawa: Binani's victory at Court of Appeal shows women have arrived - Gummi". Daily Post Nigeria. Retrieved 2026-05-22.