Jump to content

Yemisi Ransome-Kuti

From Wikipedia

Yemisi Ransome-Kuti na Naija aktivist wey don fait wel-wel for civil sosaiti and gel-pikin edukeshon. Shi bi faunda of Nigerian Network of Non-Governmental Organizations (NNNGO).

Shi bi onli pikin of Azariah Olusegun Ransome-Kuti, wey be Chief Pharmacist for Naija from 1956. Na King George VI giv am MBE taitul for 1951.

Yemisi na gel-pikin-pikin of Rev. Canon Josiah Ransome-Kuti, and ha anti Chief Funmilayo Ransome-Kuti na strong feminist wey ivun folo go beg British pipul for Naija independence.[1]

Shi stil bi kosin to Fela Kuti, Beko Ransome-Kuti, Olikoye Kuti, and Wole Soyinka (wey bi fest Afrika pesin wey win Nobel Prize for Literature).

Nau wey dem don kpai, Yemisi na di hed of di Ransome-Kuti famili.

She get four pikin: Segun Bucknor, from ha fest hosband Naval Captain Frederick Oluwole Bucknor (wey don kpai), den Bola, Seun, and Eniola Soyemi, from her sekond hosband, Dr. Kunle Soyemi.

For eli 1990s, shi stat "Girl Watch", to help tren and eduket pwo gels for Naija.

Shi stat NNNGO for 1992, wey na fest kaind of NGO netwok for Naija. Dem dey bring NGOs togeda to wok as one vois for beta divelopment.[2]

For 2006, World Bank chuz ha as Civil Society Advisor.

Shi join pipul wey dey push mek Naija rich Millennium Development Goals and end povati.[3]

Awod wey dem giv am

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 28 May 2022, shi win Outstanding Intellectual of the Year Award from Women of Inestimable Values Foundation for Lagos.[4]

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. Sansom, Ian (11 December 2010). "Great Dynasties: The Ransome-Kutis". Theguardian.com. Retrieved 2025-04-24.
  2. Carlos Moore (1 August 2011). Fela: This Bitch of A Life. Omnibus Press. p. 18. ISBN 978-0-85712-589-7.
  3. Kate (22 July 2016). "Yemisi Ransome-Kuti can die fighting injustice". Feminine.com.ng. Archived from the original on 2017-12-04. Retrieved 2025-04-24.
  4. TheVanguardNgr, VanguardNewsNgr (2 June 2022). "WIV IMPACT AWARD". Vanguard.