Jump to content

Yejide Kilanko

From Wikipedia

Yejide Kilanko (wey dem bon for 1975) na Naija-Kanada wuman wey dey rait tori and wok as soshial woka. Shi popula bikos shi dey tok abaut bad bad tin wey dey hapun to wuman for ha buks. Ha fest novel, Daughters Who Walk This Path, na bestsela for Kanada for 2012.[1]

Hau shi tek stat laif and go skull

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Yejide for 1975 for Ibadan, Naija. Ha papa na yunivasiti ticha. Shi stat to dey rait poem wen shi stil bi smol pikin.[2][3][4] Shi stodi Political Science for University of Ibadan.[5]

Hau shi tek komot from Naija and bikom soshial woka

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For yia 2000, Yejide komot from Naija go United States bikos shi mari one Amerikana man. Dem two liv for Laurel, Maryland. For 2004, shi muv go Kanada and shi dey liv nau for Chatham-Kent, Ontario.[2][5][6]

For Kanada, shi stodi soshial wok for University of Victoria and University of Windsor.[3][5] Shi dey wok nau as therapist for children mental health - dat one min say shi dey help pikin wey get wahala for dia mind.[2][4]

Hau shi tek stat to rait buk

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Yejide fest dey rait poem bifor shi leta stat to rait tori buk. Na bikos of ol di sad tori wey shi dey hia from di children wey shi dey help as counselor, e pain ha so tay shi bigin rait novel to tok wetin dey ha mind.[7]

Ha fest buk Daughters Who Walk This Path kom out for 2012. Di tori hapun for Ibadan, ha hometown, and e tok abaut sexual violence - bad tin wey pipul dey du wuman and pikin. Di tori na pikin eye wi dey tek si am.[2][8][9] Pipul wey rid am tok say di buk break taboo (dat na somtin wey pipul no dey tok abaut for outside) abaut dis kain wahala, espeshiali for Naija.

Dis buk na bestsela for Kanada for some wiks. Di newspaper Globe and Mail put di buk for Top 100 buks of 2012. For 2014, big Naija raita Chimamanda Ngozi Adichie say mek pipul rid di buk for soma.

For 2016, di buk enta shortlist for Nigeria Prize for Literature, afta dem poblish am again for Naija. Bot Abubakar Adam Ibrahim win di prize wit his own buk Season of Crimson Blossoms.

For 2015, Yejide rait one shot buk wey dem kol Chasing Butterflies. E tok abaut domestic violence (wey be bitin and abuse wey dey hapun insaid mariej or rileshonship). Shi rait am to raise monei for one NGO wey dey help pipul rid buk - Worldreader.

Shi rait one buk wey bi tori of Naija nurse wuman wey dey US wey dem hosband (wey old pas dem wel wel) kpai. Di buk fest get wokin taitul Moldable Women and e enta shotlist for Guernica Prize for Kanada for 2019. Dem leta poblish am for 2021 as A Good Name.[10]

For 2018, shi rait children buk wey di taitul na There Is an Elephant in My Wardrobe. Di buk na to help pikin wey dey strogul wit wori-wori filin wey no dey let pesin rest.[11][12]

Anoda children buk wey shi rait, What the Eyes See - na tori based on one Yoruba provab - go kom out for 2025.[13]

Yejide say shi bi feminist - dat one min say shi biliv say man and wuman sopoz get di same chans. Shi say di kain tori wey shi dey rait dey always show dis bilif. Shi tok say shi get inspireshon from oda African and African-American wuman raiters like: Buchi Emecheta, Chika Unigwe, Toni Morrison, and Alice Walker.[14]

Buks wey shi don rait

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • Daughters Who Walk This Path (2012)
  • Chasing Butterflies (2015)
  • There Is an Elephant in My Wardrobe (2018)
  • A Good Name (2021)

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. "Yejide Kilanko | Penguin Random House". PenguinRandomhouse.com. Retrieved 2025-04-21.
  2. 2.0 2.1 2.2 2.3 "Newcomer Stories: Yejide Kilanko". Chatham-Kent. 2020-06-18. Retrieved 2025-04-21.
  3. 3.0 3.1 Mbaye, Ndeye Sene (2013-04-22). "Daughters who walk the path by Yejide Kilanko". Afrobooks. Retrieved 2025-04-21.
  4. 4.0 4.1 "Yejide Kilanko". Penguin Random House. Retrieved 2025-04-21.
  5. 5.0 5.1 5.2 "Yejide Kilanko". Ottawa International Writers Festival. 2012. Retrieved 2025-04-21.
  6. Carlucci, Paul (2012-09-10). "Africa: Review - Daughters Who Walk This Path". AllAfrica. Retrieved 2025-04-21.
  7. Mordi, Melissa (2019-06-03). "Yejide Kilanko: Shattering The Shackles Of Silence Through Writing". The Guardian Life. Retrieved 2025-04-21.
  8. Ullery, Sarah (2018-05-17). "10 Books by Nigerian Authors with Feminist Themes". Book Riot. Retrieved 2025-04-21.
  9. Kelly, Joanne (2012-04-28). "Setting helps tell dark story". Winnipeg Free Press (in Kánáda Ínglish). Retrieved 2025-04-21.
  10. "BN Prose – Book Excerpt: Chasing Butterflies by Yejide Kilanko". BellaNaija. 2018-05-01. Retrieved 2025-04-21.
  11. "Yejide Kilanko On the Making of "A Good Name"". BellaNaija. 2022-04-25. Retrieved 2025-04-21.
  12. "65 Canadian works of fiction to watch for in fall 2021". CBC. 2021-08-12. Retrieved 2025-04-21.
  13. "Cover reveal for What the Eyes See by Yejide Kilanko!". Transatlantic Agency. 2025-02-11. Retrieved 2025-04-21.
  14. Fantoni, Beatrice (2012-10-27). "Chatham social worker's debut novel explores young women, abuse in Nigeria". Windsor Star. Retrieved 2025-04-21.