Jump to content

Wole Soyinka

From Wikipedia
Wole Soyinka
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejAkínwándé Olúwọlé Babátúndé Ṣóyíinká Chenj-am
Fest nemWole Chenj-am
Wen dem bon am13 July 1934 Chenj-am
Ples wey dem bon amOgun State Chenj-am
MamaGrace Eniola Soyinka Chenj-am
Broda an sistaOmofolabo Ajayi-Soyinka Chenj-am
Pesin wey e mariFolake Doherty Soyinka Chenj-am
PikinOlaokun Soyinka Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokBritish English Chenj-am
Pat of wok wey e put mindperforming arts Chenj-am
Post wey e deyUNESCO Goodwill Ambassador Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Leeds, University of Ibadan, University of London, Abeokuta Grammar School Chenj-am
E pipulYoruba pipul Chenj-am
Magnum opusSeason of Anomy, The Interpreters, Chronicles from the Land of the Happiest People on Earth, Harmattan Haze on an African Spring, The Lion and the Jewel Chenj-am
Dem kip am forLeeds University Library Chenj-am
Memba ofAmerican Academy of Arts and Sciences, Royal Society of Literature Chenj-am
Official websitehttps://www.wolesoyinkafoundation.org/ Chenj-am
BibliographyWole Soyinka bibliography Chenj-am
Documentation files atSAPA Foundation, Swiss Archive of the Performing Arts Chenj-am

Akinwande Oluwole Babaunde Soyinka (dey bon am 13 July 1934) na Naija buk-raita wey pipo Sabi wel wel for im poem an play-raita. Soyinka don rait three novel, ten smol smol stories, seven koleshon wey get poem, twenti-five play an five memoirs. E don rait two buk wen dem don intaprit to anoda langwej-dem an plenti tori for niuz-pepa. Pipo no Soyinka as one of di best raita wey Afrika don eva produs. Soyinka stil bi one of di best drama raita for di wold. Na Soyinka kolet di 1986 Nobel Prize awod in Literashon.

Dem bon Soyinka for Aké wey de Abeokuta inside one Yoruba famili wey dey go Anglika chorch. Soyinka go Govamet kolej wey de Ibadan. E kom go Yunivasiti Kolej Ibadan. Wen Soyinka de Yunivasiti, e join bodi to gada pipo form "Pyrate Confraternity ". Soyinka komot for Naija go England go rid buk for Yunivasiti of Leeds. Wen e de Yunivasiti of Leeds, Soyinka bikom di editor of di yunivasiti magasin. Di nem of magasin na "The Eagle". In di 1950s, Soyinka kom tek raitin as im mejo job. Soyinka start to dey rait smol smol stories an dey mek rekod for di BBC Lecture Series. E rait plenti play wey Dem do inside redio an hall wey pipo dey go luk drama for Naija an for UK. Na for di Royal Court Tihatia Soyinka yuz pass.

Soyinka mari Folake Doherty in 1989. Folake Doherty go bi di nomba three wuman wey Soyinka don mari for im life. For 1 September 2022, Yunivasiti of Abu Dhabi wey de New York mek Soyinka dia Art Professor of Tihata

Plenti buk-dem wey Soyinka rait dey tok about Naija. Dis one mins sey Soyinka buk dey tok about Naija histri, kolshor, an dia govamet. Pipo sabi Soyinka wel wel bikos of some of im like: Swamp Dwellers (1958), The Lion and the Jewel (1958), an, The Invention. The Invention na one of Soyinka play wen e start to dey rait play

Wole_Soyinka_in_2018-2