Wale Ojo
Wale Ojo na British Naija aktor. I stat i akting karia from smol as a child aktor for televishon, and i still dey akt op till now. I bikom popula for 1995 for di rol wey i pla for "The Hard Case". im win di aword for Best Aktor for di 2012 Nigeria Entertainment Awards for i leading rol in "Phone Swap" .
How i tak stat life and Edukashon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ojo don dey akt professionally from smol. At di age of 8 i work with Akin Lewis, wey pla di rol of a barber for di NTA Ibadan 1980s televishon siris "Why Worry". At age 12, I follow i family go England, where im tak go Universiti. Ojo talk sey na i mama influence am to stat i akting karia. Others wey support i karia bi Chief Wale Ogunyemi, Tunji Oyelana, playwright Wole Soyinka, and Zulu Sofola.
New Naija Cinema
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ojo stat di "New Naija Cinema" to improve di quality of Naija fims. New Naija Cinema get where persin fit watch fim and lectures from di British film Institute for London in 2010.