Wale Adenuga
Wale Adenuga (dey bon am 24 September 1950) na Naija forma poblisha an pesin wey dey draw bebi for pipo to fit laff. Na Adenuga bi di produsa of Ikebe Super, Binta and Friends an Super Story. Adenuga get one televishon prodonshon kompini kol WAP.
How im tek start life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Adenuga papa dey sel tobakko. Na for Ibadan Adenuga tek gro. E go Ibadan City Academy Wie e kolet im O-Levul satifiket. Adenuga kom go King's Kolej wey dey [Lagos|Legos]]. Wen Adenuga stil de King's Kolej, e form one band wey leta skata as all of dem finish do skul
Im work as poblisha
[chenj-am | chenj-am for orijin]Adenuga Stodi Bizness Hadministrashon at di Yunivasiti of Legos I 1971. E dey work for di Campus Magazine of di skul. Na im dey draw di fonni kartun wey dey de inside di magazine. Afta Adenuga finish Yunivasiti in 1975, e go do youth kopa in Bendel. In 1975, Adenuga start im Ikebe Super magazine. Na inside di Ikebe Super magazine di tori of Papa Ajasco de. Papa Ajasco na one tori of a man wey like wuman wel wel an Alinko na young boi wey like wuman too. Papa Ajasco tori stil get Miss Pepeiye inside too. Adenuga stil get anoda magazine wey dey karia di Super Story. Anoda magazine wey Adenuga dey produs na Binta. Binta na one tori wey konsain smol pikin tori.